Wetin Peter Obi and Govnor Bala Mohammed discuss for dia closed-door meeting

Wia dis foto come from, X/@SenBalaMohammed
Presidential candidate of Labour Party (LP) for di 2023 elections and former govnor of Anambra state, Peter Obi visit di govnor of Bauchi state, Bala Mohammed, wia dem hold closed-door meeting to discuss on some national issues.
Di meeting bin hold for di Ramat house inside Bauchi state on Thursday 13 March, 2025, Obi visit wit some of im entourage wey dey waka wit am.
All eyes dey for di meeting as many dey wonder why di Labour Party 2023 presidential candidate dey meet wit Govnor Bala, some wonder if e get any link to preparations for di 2027 elections.
Meanwhile, Peter Obi for di presidential election on February 25, 2023 bin come third behind Atiku Abubakar of di Peoples Democratic Party (PDP) wey come second and Bola Tinubu of di All Progressives Congress (APC) wey win di election.
For di result wey Inec announce, Tinubu get 8,794,726 votes, Atiku wey come second get 6,984,520, while Obi get 6,101,533 and Rabiu Kwankwaso of di NNPP get 1,496,687.
Since afta di election, Peter Obi neva rest to dey visit different parts of Nigeria to meet and discuss wit several politicians, ranging from govnors to elder statesmen and political stakeholders.
Why Obi meet Govnor Bala

Wia dis foto come from, X/@SenBalaMohammed
According to di Bauchi state govnor afta di meeting, e say dem discuss on unity plus oda national issues wey go make di future of di kontri dey brighter.
E dey clear say many issues dey face Nigeria at di moment, Govnor Bala say dem get meaningful conversation on national issues, even though e no clearly say anytin wey link to di 2027 election.
"During our discussions, I tok about my steady commitment to encourage unity and fight division, and also say patriotism remain di foundation of a brighter future for our nation," Govnor Bala tok for im statement.
While im dey tok about Peter Obi, Govnor Bala say im like di dedication and leadership style of di former Anambra state govnor.
E add say how Obi dey waka round to visit and engage wit important stakeholders for di kontri dey totori am.
"I commend Mr. Obi for im visit and acknowledge im dedication to nation-building and inclusive leadership."
"Im commitment to engage wit key stakeholders and contribute to national discourse dey truly commendable."
Di major reasons why Obi bin visit Bauchi govnor na to greet am ova recent loses and to continue consultation wit stakeholders, according to Govnor Bala.
"Mr. Obi stated say im visit na to express im condolences ova recent losses, engage in meaningful discussions on national issues, and deepen consultations wit relevant stakeholders."
Those wey follow Obi include former Minister of Finance, Mrs. Nenadi Usman wit oda dignitaries as dem also go pay homage to His Royal Highness, di Emir of Bauchi, Alhaji (Dr.) Rilwanu Suleiman Adamu for im palace

Wia dis foto come from, X/@SenBalaMohammed
Peter Obi bin don say im mission na to promote new Nigeria and dis no go change as im mission no end wit di Supreme Court decision on 26 October 2023.
E tok am afta di Supreme Court ruling of di 2023 presidential elections confam Tinubu as winner of dat election.
Howeva, since dat time, di race for di 2027 election and who go contest or merge togeda don begin for different corners.
Of recent, former Kaduna State govnor, Nasir El-Rufai bin dump di All Progressives Congress (APC) for di Social Democratic Party (SDP).
El-Rufai tok am say e wan challenge di APC for 2027 but e neva tok those wey go dey wit am.
Howeva, Peter Obi too and im party dey reported to dey on di lookout for strong alliance wey go allow dem comot di ruling APC for power by 2027.









