Court deliver judgement on rape accuse against Manchester City footballer Benjamin Mendy

Wia dis foto come from, Getty Images
Chester Crown Court for di United Kingdom no find Manchester City footballer Benjamin Mendy guilty of six counts of rape and one count of sexual assault.
Jurors no fit reach verdicts on one count of rape and one of attempted rape afta six months trial.
Di prosecution seek retrial on dose counts and dem don schedule am for 26 June.
Oga Mendy and im friend Louis Saha Matturie chop accuse of various sex offences against young women.
Chester Crown Court no also find 41-year-old Matturie guilty of three counts of rape. Matturie na Mendy co-accused.
Jurors also fail to reach verdicts on three counts of rape and three counts of sexual assault against am.
Oga Mendy cova im face wit both hands as di jury foreman repeat "not guilty" to di six counts, wey relate to four young women or teenagers.
Di seven men and four women on di jury deliver di unanimous verdicts on Wednesday. Dem bin discharge one juror earlier sake of medical reasons.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dem bin no report di verdicts until jurors conclude considering di remaining two counts, afta Judge Steven Everett give dem majority direction, meaning say im go accept 10-1 majority on any verdict.

Wia dis foto come from, Getty Images
But afta 14 days of deliberation, jurors bin no reach verdicts on Mr Mendy alleged attempted rape of one 29-year-old for 2018 and di alleged rape of anoda woman, 24, for October 2020.
Judge Everett discharge di jury on Friday and end di trial.
Both men don dey on trial since 10 August as 13 women accuse dem of multiple sexual offences.
Matthew Conway say di prosecution go seek retrial on di counts di jury no fit reach verdicts on.
E say: “Di prosecution don make decision. We don make decision today, wey be to proceed on these counts in two separate trials and we seek today provisional case management."
One statement from Manchester City say: "Sake of say open matas dey wey relate to dis, di club no dey in position to comment further at dis time.”
Di allegations and trial na "absolute hell" for Mr Mendy, di court tok, wit im life in football "ova" as e "no go ever escape" di accusations.













