Supreme Court reserve judgement on Nnamdi Kanu case

Nnamdi Kanu for court with im lawyers

Wia dis foto come from, BBC

Supreme court of Nigeria don reserve judgement for di case of di leader of di Indigenous People of Biafra (Ipob), Nnamdi Kanu to 15 December, 2023.

Supreme court tok as di mata come up on Tuesday for Abuja.

For court today, counsel to di federal goment Tijani Gazali ask di court to set aside di Appeal Court judgement wey free Nnamdi Kanu from criminal charges.

"We urge my Lords to set aside di judgement of di Appeal Court wey clear Kanu from standing trial and affirm di decision of di Federal High Court for Kanu to stand trial.

We urge di court to also dismiss di cross appeal for lack of merit." Gazali tok.

On di oda hand, counsel to Nnamdi Kanu, Mike Ozekhome tell court to uphold di Appeal Court judgement.

"We urge di court to dismiss di main appeal and uphold di cross appeal in oda to do justice to dis mata so dat di respondent wey dey incarcerated since June 2021 go get justice.

Make court also use dis case to demonstrate say no man, goment or citizen dey above di law as dis case get global and international attention." E tok.

Mike Ozekhome also withdraw di motion e bin file on 8 Feb 2023 wia e file for transfer of Nnamdi Kanu from DSS hand to Kuje Correctional Centre.

Di second motion wey e withdraw na on 9 Feb 2023 e file am.

Di motion na for court to grant di respondent bail so dat e go dey alive to stand trial.

Anoda motion wey e withdraw na di one on accelerated hearing, so dat court go hear di case sharp sharp.

Ozekhome withdraw di motions sake of say e don dey overtaken by events.

"Court withdraw and strike out di motions". Justice Kudirat Kekere-Ekun tok.

Counsel to Nnamdi Kanu Mike Ozekhome, SAN bin file two motions, one na to release am on bail, di second na to transfer am from DSS custody to Kuje Correctional Centre, Abuja.

Meanwhile Court of Appeal for Abuja bin don discharge Nnamdi Kanu from all charges and also tok say e dey illegal to detain or continue to try am.

Goment go di same court of Appeal wia dem give dem 'Stay of Execution' order wey go continue to keep Nnamdi Kanu for detention till Supreme Court hear di mata.

Supreme Court suppose hear di mata since September 14, 2023 wey be di last adjourned date, but dem no sit again on dat day.

On May 11, di last day wey Supreme court sit sake of Nnamdi Kanu case, Supreme Court announce di adjournment afta counsel to Federal goment Tijjani A. Gazali oppose di hearing of two motions.

Di motion to grant Nnamdi Kanu bail and di motion to transfer am from DSS custody to Kuje Correctional Centre, sake of say im neva file im response.

Goment lawyer Tijani Gazali bin beg court to give am time till Friday 12 May, 2023 to file im response.

Counsel to Nnamdi Kanu Mike Ozekhome SAN, bin tell court say im dey ready for court to hear di mata but di judges say dem no go fit do anytin dat day.

Im bin beg di judges to give dem di nearest possible date sake of say di condition wey Nnamdi Kanu dey for DSS custody bin no good.