British singer Adele burst into tears as she hug Celine Dion for Las Vegas show
British singer Adele burst into tears as she hug Celine Dion for Las Vegas show
British superstar Adele burst into tears afta she spot Celine Dion for concert residency for Las Vegas.
Di two singers den share emotional hug inside di Colosseum Theater at Caesars Palace, venue wey dem originally build for Dion 2003 debut residency.
"Dis truly feel like she bin dey proudly handle di keys to Adele," Nasser, wey bin dey among di audience and film di moment on im phone, tell BBC News.
"And wen Adele give her dat hug, evri one feel wetin dem feel."
Adele dey known to idolise di Canadian icon, while Dion don also tok beta tins about Adele.






