Indonesia make law to punish sex before marriage wit jail term

One woman for Aceh, Indonesia, before dem cane am for November say she get sex outside marriage. Aceh province already get strict laws against sex outside marriage

Wia dis foto come from, HOTLI SIMANJUNTAK/EPA-EFE/REX/Shutterstock

Wetin we call dis foto, One woman for Aceh, Indonesia, before dem cane am for November say she get sex outside marriage. Aceh province already get strict laws against sex outside marriage

Indonesia parliament dey expected to pass one new criminal law dis month wey go punish sex outside marriage wit imprisonment of up to one year.

Bambang Wuryanto, one politician wey get hand for di draft, say dem fit pass di code fit as early as next week.

Di law, if dem pass am, go apply to Indonesian citizens and foreigners alike.

Punishment for adultery fit only take effect if parties wey lodge complaints to di authorities dey.

For doz wey don marry, di party wey dey entitle to lodge complaint na di perpetrator husband or wife.

Di law also allow make parents of unmarried pipo report dem say dem get sex.

Cohabitation bifo marriage go also dey banned and doz wey dem convict fit face six-month prison sentence.

Business groups don express worry about di damage wey di rules fit do to Indonesia image as holiday and investment destination, according to tori pipo Reuters.

Shinta Widjaja Sukamdani, deputy chairperson of Indonesia Employers' Association (APINDO), sa: "For di business sector, di implementation of dis customary law go create legal uncertainty and make investors reconsider make dem invest for Indonesia."

Di previous draft of di code dey set to pass for 2019 but bin cause nationwide protests wia tens of thousands bin take part for di demonstrations.

Plenti pipo, including students, bin enter streets for cities across Indonesia wit di main clashes wey shelle for di capital Jakarta.

Tear gas and water cannon dey used against protesters wey bin throw stones for police.

Wetin we call dis Video, Tear gas fire as Indonesia sex ban protests kontinu

Dat kind strict laws on sex and relationships no dey without example for parts of majority-Muslim Indonesia.

Di province of Aceh enforces strict Islamic law and don punish pipo for gambling, drinking alcohol and meeting members of di opposite sex.

For one case for 2021, neighbours bin denounce two men sake of dem get sex. Di two bin collect 77 lashes each from one police officer for di public caning.

For di same day one woman and man each bin kollect 20 lashes sake of dem catch dem for close proximity to each oda, and two men kollect 40 lashes each say dem get drunk.