How to use di new NCC short codes buy data, check airtime balance and do oda tins for your mobile network

Wia dis foto come from, others
Di new harmonised short codes wey di Nigerian Communications Commission, NCC direct all mobile network providers to dey use for certain services na im be di koko now o!
Una know say all di mobile networks for Nigeria get different different codes wey dem dey use recharge dia phone if dem wan buy airtime, data, call customer care or do oda tins.
But di Nigeria Communications Commission don tok say e no go hppun again as dem don direct all telecom consumers for di kontri to scrap all dia codes and begin use di new one wey be di same codes for all networks.
NCC say dis move dey in line wit dia approach to put consumer first.
According to NCC, di initiative dey essentially to make life easier for telecom consumers, as e go now dey easier for Nigerians to memorise single codes for various services across all mobile networks wey dem dey use.
NCC say dem want make all di short codes be di same across all networks.
Wetin be di new codes and how to use dem?
Before now di main mobile networks for Nigeria like MTN, GLO, 9mobile, Airtel and odas get different codes wey dem dey use buy airtime, data, call customer service, change line or do oda tins, but now di codes go be di same across all networks.
Di commission approve 13 common short codes wey be di same for evri mobile network, di codes na:
End of Di one wey oda users dey read well well
300 : If you wan reach Call Centre/Help Desk on all mobile networks
301: If you wan drop voice mail for anybody
302: If you wan listen to voice mail message wey you receive
303: If you wan borrow airtime or data or any oda services wey your network dey offer.
305: To stop any service wey your network dey provide, e’g callertunez.
310: If you wan check your balance
311: To buy airtime
312: If you wan buy data plan across all networks
321: To share services
323: If you wan check your data plan balance
996: If you wan check if your SIM (Subscriber Identity Module) dey linked to your NIN
2442: na for Do-Not-Disturb (DND), if you dey get unsolicited message
3232: if you want port from one network to di oda.
Wit di new codes, di telecom consumers wey dey use ova 226 million active mobile lines for di kontri, fit now use di same codes to access services across di networks.
Dis new policy wey network providers don already start to use go provide opportunity for licenses for di Value-Added Services, VAS segment of di telecoms sector, so dat di old codes wey don dey free now oda services fit use dem NCC tok.
Di Commission don already set deadline of 17 May, 2023, for all mobile networks to fully migrate from dia short codes to di new harmonised codes.
But consumers go still fit use di old and new harmonised short codes until di May 17, 2023 deadline.

Mobile networks wey don switch to di new codes
Some mobile network providers for Nigeria don already announce say dem don switch to di new NCC short codes.
Mobile giants Airtel Nigeria don already start to create awareness about di switch ontop dia official twitter handle.
Dem say "New codes, same reliable services"
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Oda mobile neva announce dia roll out but di codes don begin work for some of dem.
Dis announcement dey come several months afta di Nigerian Communication Commission mandate all telecoms consumer to link dia mobile phone SIM card numbers to dia National Identity Number, NIN.
Di National Identification Number na wetin goment dey use establish di identity of evri Nigerian.
Tori be say na for 2020 goment introduce di policy for evri mobile phone user to register dia sim and link am to dia NIN.
Di aim of di registration na to get data base of all Nigerians.
President Muhammadu Buhari give di directive for di implementation and commencement of di exercise for December 2020, as part of di administration security and social policies.
Meanwhile di NIN-SIM registration still dey go on nationwide.















