Wetin to know about di billionaire and spiritual leader Aga Khan wey die

Wia dis foto come from, PA Media
- Author, Nathan Williams
- Role, BBC News
- Read am in 4 mins
Billionaire philanthropist and spiritual leader Aga Khan don die at di age of 88, im charity the Aga Khan Development Network don announce.
Prince Karim Aga Khan na di 49th hereditary imam of di Ismaili Muslims, wey trace im lineage directly to di Prophet Muhammad.
E "passed away peacefully" for Lisbon, Portugal, surrounded by im family, im charity tok inside statement on social media.
Born for Switzerland, e bin get British citizenship and live for chateau inside France.
E be friend to both King Charles and im mother, di late Queen Elizabeth II.
The Aga Khan charities run hundreds of hospitals, educational and cultural projects, mainly for di developing world.
E enjoy rich lifestyle, with private island in di Bahamas, a super-yacht and a private jet.
The Aga Khan Development Network say dem offer dia "condolences to di family of His Highness and to di Ismaili community worldwide".
"We continue to work with our partners to improve di quality of life for individuals and communities across di world, as e wish, irrespective of dia religious affiliations or origins," dem add.
Di Ismailis, wey be Muslim sect, get a worldwide population of about 15 million, including 500,000 for Pakistan. Large populations also dey for India, Afghanistan and Africa.

Wia dis foto come from, PA Media
Prince Karim Aga Khan succeed im grandfather as imam of di Ismaili Muslims for 1957 at di age of 20.
Di prince bin get an estimated fortune of $1bn (£801m) for 2008, according to Forbes magazine. Im boost im inherited wealth with plenti business interests, including horse-breeding.
E become a leading owner and breeder of race horses for UK, France and Ireland, e breed Shergar, wey once be di most famous and most valuable racehorse for di world.
Shergar win di Derby for Epsom for 1981 by 10 lengths for the Aga Khan emerald green racing silks with red epaulets but dem kidnap am for Ireland two years later and dem no ever find am.
Despite losing im beloved horse, e tell BBC for 2011 - on di 30th anniversary of Shergar biggest win - say e no tink am to abandon im Irish breeding operation.

Wia dis foto come from, PA Media
Concerning Shergar win, e say: "na one memory wey no fit ever, ever go away.
"I don see dat film I no know, tens or hundreds of times. I keep trying to analyse where dis ogbonge performance come from. Every time I see di film, I feel say I don learn something.
"If you dey into racing, di Epsom Derby na one of di greats. Na so e don always be, so to win a race of dat quality by imsef na extraordinary privilege. To win am di way e win am come even dey more an dat.
"I don watch enough races to be able to determine wetin di jockey bin dey feel, how di horse bin dey go at di time and wen e come around Tattenham Corner, I bin no fit believe my eyes.
"Im victory up to dis point in time dey unique. Two tins wey shock me - one na di way dat horse move and second na di fact say during di finishing straight e just continue to dey go away, dey go away, dey go away. Dat bin really dey remarkable."
The Aga Khan go on to win di big race another four times with Shahrastani (1986), Kahyasi (1988), Sinndar (2000) and Harzand (2016).
Other notable successes include di 2008 Prix de l'Arc de Triomphe with di Zarkava horse wey bin dey unbeaten..
Di prince na also di founder of di Aga Khan Foundation charity prince and give im name to bodies including a university for Karachi, and the Aga Khan Program for Islamic Architecture for Harvard University and di Massachusetts Institute of Technology.
The Aga Khan Trust for Culture dey key to di restoration of di Humayun Tomb site for Delhi. One every year Aga Khan Award for Architecture event also dey.
And na im form The Nation Media Group, wey don become di largest independent media organisation for east and central Africa.
Pakistan Prime Minister Shehbaz Sharif pay tribute to di prince wey e describe as a "man of vision, faith, and generosity" and a "remarkable leader".
"Through im tireless efforts in poverty alleviation, healthcare, and gender equality, e champion di cause of di marginalized, leaving correct mark on countless of lives," e tok.
Activist and Nobel Prize laureate Malala Yousafzai say: "Im legacy go continue to live on through di incredible work e lead for education, health and development around di world."
UN Secretary-General Antonio Guterres describe am as a "symbol of peace, tolerance and compassion in our troubled world".







