Canadian company find second-largest diamond in di world for Botswana

Wia dis foto come from, LUCARA DIAMOND
Dem don see di second-largest ever diamond for di world for Botswana.
One Canadian firm, Lucara Diamond bin unearth di 2,492-carat stone from dia mine for Botswana.
Na di biggest diamond dem go ever find since di 3,106-carat Cullinan diamond, dem discover for South Africa for 1905.
Dem bin cut am into nine separate stones, and many of dem dey for di British Crown Jewels.
Dem discover di diamond for Karowe mine, wey dey about 500km (300 miles) north of Botswana capital, Gaborone.
Wetin to know about di diamond
For one statement, Lucara say di stone na "one of di largest rough diamonds ever unearthed".
"We dey very happy about di recovery of dis extraordinary 2,492 carat diamond," Lucara boss, William Lamb tok.
Di firm no give details about di gem quality or im value.
Na French fashion brand Louis Vuitton bin buy di 1,758-carat stone wey dem bin find for 2019 for moni wey dem no disclose di sum.
Dem bin sell one 1,109 carat diamond, wey dem unearthed for di same mine for 2016, for $53m (£39.5m) to London jeweller Laurence Graff, chairman of Graff Diamonds, for 2017.
Na Lucara Mega Diamond Recovery X-ray technology dem use detect di diamond, Oga Lamb tok.
Di organisation don dey use am since 2017 to detect and preserve high-value diamonds so dat dem no go break during ore-crushing processes, according to di Miningmx publication.
Lucara get 100% ownership of di mine for Karowe.
Botswana government don propose one law wey go ask companies dem grant license to mine, to sell 24% stake give local firms if di government no exercise di option say dem wan become shareholder, Reuters news agency bin report for July, 2024.
Anoda ogbonge diamond dey don discover
For 2022, miners for north-east Angola bin discova one rare, pure pink diamond, di Australian site operator bin announce on Wednesday 27 July.
Dem believe say di rough diamond na di largest dem don find in 300 years.
Di Australian site operator name di 170-carat stone The Lulo Ros.
Tori be say dem discover di precious stone for Lulo mine inside di kontri diamond-rich northeast.
And e dey among di largest pink diamonds ever dem don find.
Na wetin Lucapa Diamond Company tok for one statement to investors.
Di "historic" find of di Type IIa diamond, one of di not too common and purest forms of natural stones, dey welcomed by di Angolan government, wey be also partner for di mine.
"Dis record and spectacular pink diamond recovered from Lulo continue to showcase Angola as one important player ontop di world stage."
Angola Mineral Resources Minister Diamantino Azevedo bin tok.








