Five health benefit of lemon

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Abubakar Maccido
- Role, Reporter
- Reporting from, Kano
- Read am in 2 mins
Lemon (Citrus limon) na small yellow citrus fruit wey pipo sabi for im sour taste and fresh aroma. Even though e small, e full wit strong nutrients wey dey support overall health.
Lemon no get plenty calories but e rich in vitamin C, fiber, and better plant compounds like flavonoids and limonene.
E dey provide about 88% of di daily vitamin C wey pesin need.
In fact, if you weigh am gram for gram, lemon and orange get almost di same amount of vitamin C.
One dietitian for Kano, Aisha Bala Ahmad, tell BBC News Pidgin say lemon no be aphrodisiac, "but e dey support libido through detox and general bodi health."
"E high for Vitamin C, e dey help blood flow and reduce stress (and stress fit reduce libido)," she add.
Even though lemon get plenty nutritional benefits, especially as e rich in vitamin C and antioxidants, di most important tin wey person suppose consider na dental health.
Health benefits of lemon
- E dey boost immunity: E rich in vitamin C wey dey make immune system strong and dey help fight cold and infection.
- E dey improve skin health: Vitamin C dey help produce collagen, reduce wrinkles, clear dark spots, and make skin bright.
- E dey aid digestion: If you drink warm lemon water, e fit help indigestion, bloating, and constipation.
- E dey prevent kidney stones: E get citric acid wey dey bind wit calcium and help stop kidney stones from forming.
- E dey help wit iron absorption: Vitamin C wey dey lemon dey help bodi absorb iron from plant food, wey fit help prevent anemia.
Nutritional profile of lemon (per 100g, raw, witout peel)
- Calories: ~29 kcal
- Water: ~89%
- Carbohydrates: ~9.3 g
- Sugars: ~2.5 g
- Fiber: ~2.8 g
- Protein: ~1.1 g
- Fat: ~0.3 g
- Vitamin C: ~53 mg (89% RDA)
- Vitamin B6: ~0.08 mg
- Potassium: ~138 mg
- Folate (B9): ~11 g
- Citric acid: ~5–8% (main acid)
Caution: Sabi pipo say lemon get high acidity, e fit cause serious enamel wear for teeth, so pipo wey dey take am regular suppose protect dia teeth well. Make pesin use am wit sense say make e no just dey carri use am, also, make e follow beta method to enjoy di benefits witout wahala.







