Wetin Earth Day don achieve?

Wia dis foto come from, Getty Images
Na millions of pipo for di world dey gada to mark Earth Day and also celebrate di movement for di environment.
Since di event bin begin for 1970 for di United States, dem begin dey observe am around di world.
Wetin be Earth Day and wen e be?
Earth Day na global event wey dey aim to show how important to dey protect di environment be and na 22 April every year dem dey celebrate am.
Na US senator and environmentalist by Gaylord Nelson, and Denis Hayes one graduate student for Harvard University bin set am up for 1970.
Di two of dem bin get concern about environmental damage wey dey happun for US.
Dem come up wit Earth day as a way for dem to engage di public and push matters wey concern green issues to di national agenda.
Di first Earth Day bin see about 20 million pipo across di US wey take to di streets.
E come become a global event for 1990, and now, e involve ova one billion pipo of all ages for nearly 200 kontris, according to wetin organisers tok.
End of Di one wey oda users dey read well well
"Celebrating Earth Day na di first environmental action for a lot of pipo," Earthday.org president, Kathleen Rogers tok.

Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin dey happun for Earth Day 2024?
Di 2024 theme, "Planet vs. Plastics", dey aim to to raise awareness of di kain harm wey plastic pollution don cause for human and health for di planet.
Events wey don happun before bin cover different range of issues, from climate change and clean energy to how dem go dey protect species and di benefits of planting trees.
Dis year focus na sake of one historic UN treaty on plastics, wey dey expected to dey agreed upon by 2024.
More dan 50 kontris wey include di UK don make call for di end to plastic pollution by 2040.
But di organisers of Earth Day wan go further, and dem dey call for a 60% reduction for di production of all plastics by 2040.
Organisers don suggest say pipo fit volunteer for a clean-up event or learn more about di damage wey plastic pollution don cause.
Wetin Earth Day don achieve?
Within a few years of di first Earth Day for 1970, di US Environmental Protection Agency don set up several environmental laws - such as di Clean Air Act.
More recent events don include planting hundreds of millions of trees, supporting farmers wit sustainable agriculture practices, and to dey begin teach pipo about climate.
Some observers don tok on di importance of Earth Day.
"Wit a host of issues wey dey drive our environmental challenges down, events like Earth Day dey remind us of di long-term cost of short-termism," Yvo de Boer, former UN climate chief tok.
For 2016, dem choose Earth Day as a symbol to officially sign di landmark Paris climate accord, wey dem don agree for late 2015.
Na di first time wey kontris for di world bin agree on targets to try to limit global warming.
Wetin tok tok pipo say about Earth Day?

Wia dis foto come from, Getty Images
Some ogbonge pipo dey warn say dis kain achievements dey be like say di progress no real.
Many environmental indicators from global temperatures to animals wey no dey again dey change sake of human activities. All di efforts to stop dis kain wahala no dey successful.
Some individuals and companies don also chop accuse say dem dey use Earth Day as an opportunity to mislead and promote dia own environmental record but dem no dey make di real changes.
Dem call am "greenwashing".
For example, campaigner Greta Thunberg bin tweet for 2022 say Earth Day "don turn into an opportunity for pipo wey dey power to post dia 'love' for di planet, while at di same time dem dey destroy am wit maximum speed".
"We all know say greenwashing dey happun and e dey annoying," Earth Day organiser Ms Rogers tell BBC News.
"No be issue wey we cause, but we know say Earth Day dey help some businesses to use di campaign to dia own gain."
"Goment need to take robust action and crack down on any business or industry wey dey lie give consumers."













