Wetin parent of student wey allegedly insult Aisha Buhari tok

Wia dis foto come from, OTHERS
Di parents of one University student for Jigawa state wey allegedly insult Nigeria First Lady Aisha Buhari dey beg for im release.
Aminu Adamu Mohammed na student of di University of Dutse for Jigawa state.
Security forces allegedly pick am up sake of one post wey im tweet about di first lady.
For di tweet, e post foto of Aisha Buhari before e come write for Hausa language say she don gain weight in di last couple of years.
(BBC no fit verify dis tweet).
Tori of Aminu disappearance begin circulate over di weekend after im colleagues for school say dem no see am and im parents also begin dey wonder wetin happun to dia boy.
Wetin Aminu Mohammed tweet

Wia dis foto come from, Amnesty International Nigeria
Local tori say na for June 8, 2022, Muhammed bin tweet say one foto of di first lady, Aisha Buhari and caption am wit one post wey e write for Hausa language; “Su mama anchi kudin talkawa ankoshi”, wey mean say “di mother don grow fat sake of say she dey chop masses money”
However BBC, no fit independently verify dis tweet.
End of Di one wey oda users dey read well well
Wetin di parents tok
Parents of Aminu Adamu Mohammed don beg di first lady to release dia son wey security pipo allegedly pick up from im school last week sake of di comment e post on Twitter.
Di papa of di boy say im bin receive one very short call from im pikin say im dey Abuja say security gbab am for something wey im post on Twitter.
Di tori be say for one report wey concern Nigeria First family Aminu bin enter comment section wia e post foto of Mrs Aisha Buhari before e come write for Hausa about her body weight gain in di last couple of years.
Shehu Baba Azare na uncle of Aminu and na im speak on behalf of di family wia e tell BBC say dem dey beg for forgiveness from Mrs Buhari and plead for di release of dia pikin.
“All we know be say wife of di president na mother to all and we dey beg for forgiveness and di release of our pikin, as a mother please see to di release of Aminu.”
One of di student leaders for Federal University Dutse Khalid Mohmmed tell BBC Pidgin say dem dey start exams next week and di detention fit affect im performance.
“Aminu na final year student wey dey plan to start im final exams like all students by next week so we dey beg for im release so dat e fit prepare for exams.”
E add say dem happy as internal groups and bodies dey chook mouth for di mata wey go helep aid di release of dia student.
How pipo dey react

Wia dis foto come from, Amnesty International Nigeria
Meanwhile, #FreeAminuAdamuMohammed dey trend for social media.
Many pipo andgroups don call for di release of di undergraduate.
Di Amnesty International for statement call for immediate release of Aminu. E say e dey illegal to dey continue to hold am and deny am access to lawyers and im pipo.
Oda pipo too don join mouth to call for di release of di 23 year old undergraduate.
We still dey chook eye for dis tori
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

Wia dis foto come from, TWITTER

Wia dis foto come from, TWITTER

Wia dis foto come from, TWITTER













