Wizkid, fans join review of Davido 'Timeless' album

Wia dis foto come from, @Davido/Twitter
Ogbonge star Wizkid don stamp approval say make pipo carry dem sef go listen to Davido latest album, Timeless.
E tok dis one for social media say, "Make all of una go listen to my bros, Davido, Timeless".
Dis dey follow di reviews wey just dey pour in up and down, less dan 24 hours afta di album.
Pipo hype di song sotay, Davido don drop dancestep for di Unavailable track of di album.
Already pipo don dey drop dia favourite tracks from d album.
While odas still dey tok about di differences dem don find for Davido sound for di albums.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3

End of X post, 4
Davido bin reveal for im album say, “I remember as I siddon dey look over di ocean not too long ago, and dey wonder if I fit get here again, afta all I don go through…” E tok.
Timeless album dey come afta di ogbonge singer lose im first son, Ifeanyi Adeleke to di cold hands of death on October, few days afta e clock three-year-old.
End of Di one wey oda users dey read well well
Autopsy bin reveal di cause of death as drowning according to di Lagos state police command.
E take di opportunity to thank im wife, Chioma as well as fans wey chill for ma.
As well as di album, Davido set aside three dates for April wey e go perform concert for London, New York and Lagos.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 5
Davido drop Timeless on 31 March to di delight of fans wey don dey wait for im return to di music scene afta im take break from social media afta di death of im son Ifeanyi Adeleke wey im born wit im wife Chioma three years ago.
Di singer bin delete many photos and videos from im Instagram page and drop one video where im announce di release of im fourth studio album.
Di announcement mark Davido return to social media, and fans bin happy well-well say OBO dey return afta di break, and dem begin anticipate di Timeless album.
"At long last - WE don come back. Di journey from my last album to dis album na whirlwind to say di least. I remember say I bin sit & stare ova di ocean not too long ago, as I dey wonder if I fit get here again, afta all I don go through… but wit your love & support, we make am.
"I no dey sure wetin come afta dis but I bin wan give you my heart, soul and energy. Today I present you “TIMELESS”, "Davido write for im Twitter page.
'Thank you to di strongest woman wey I know'

Wia dis foto come from, @Davido/Instagram
"So many pipo to thank but first I must say special thank you to di strongest woman wey I know, Chioma." Davido tok.
Davido for im thank you message, thank Chioma specially. E say she be di strongest woman wey e know.
For one very recent interview, Davido bin announce for di first time im marriage to Chioma Rowland.
Chioma Adeleke na di mother of late Ifeanyi wey she get wit David.
Davido also thank im supporters wey stand wit am during im trying period.
Colleagues, fans and supporters react to di release of Timeless
Plenty reactions don follow di release of di album as plenty congratulations don begin come in.
Ogbonge musicians like Angelique Kidjo, 2Face, Falz, Diana Russet, plus oda of im colleagues, fans and supporters don hail di artiste.
Ubi Franklin Ofem wey be music executive congratulate Davido for di new album.
"I remember many nights for studio sessions and di day don finally come. Congratulations to you and di entire team," Ubi write for Twitter.