Jada Pinkett Smith and Will Smith dey work on dia marriage

Jada Pinkett Smith and Will Smith

Wia dis foto come from, Reuters

Jada Pinkett Smith tok say she and Will Smith dey "work very hard" on dia marriage.

She tok dis one afta she reveal recently say dem don separate since 2016.

Dem no dey live togeda, she tok, even though dem dey often appear togeda.

Pinkett Smith tell NBC say dem seriously dey concentrate on "healing di relationship".

Di couple bin make headlines last year wen Will Smith para enta di stage for di Oscars and slap host Chris Rock.

E shout "Comot my wife name from your [swear word] mouth".

Pinkett Smith revelation around her relationship wit di Hollywood actor bin make headlines all ova di world.

She tell NBC Today Show say, “We dey for deep healing space now.”

“And we dey really concentrate on healing di relationship wey dey between us…

“We dey work very hard to bring back our relationship to a life of partnership.”

“He need to accept me for di pesin I be. And we wan love each oda there.”

Wen tori pesin ask am if di couple go fit still live for di same house again, she agree say, e dey possible.

Pinkett Smith for her book launch tok say she bin consider legal divorce but she no fit go through wit am because she bin dey determined to work on di marriage.

Will Smith and Jada Smith

Wia dis foto come from, Getty Images

Eralier on, di 52-year-old actress bin tok for one interview with tori pipo Today, say dem don secretly separate for about seven years.

Di presenter, Hoda ask “so from di year 2016, wey be seven years ago una two don dey apart?” “Yes” Jada Smith tok.

She reveal say dem dey legally married as couple but na ontop paper as dem no dey romantically togeda again “we dey live seperately.”

Jada Pinkett explain say she bin separate from her husband becos both of dem tire from trying but dem bin dey try to stay married becos of di fantasy of wetin individuals suppose dey do as married couple.

"Why we break up, na a lot of tins," di actress tok. "I tink by di time, we reach 2016, we don dey exhausted wit trying," Jada tok.

Wen di reporter ask her why dem bin no make di information about dia separation public, she say: "I bin tink say we neva ready, we dey try figure out between di two of us how we go fit dey in partnership and how we go show am to pipo."

Will Smith and Jada Smith dey kiss

Wia dis foto come from, Getty Images

Will Smith and Jada Pinkett marriage

Dis couple don dey Hollywood paparazi eye since afta dem marry for 1997, New Year Eve.

Di couple get two adult children for dia marrraige, Jaden Smith and Willow Smith.

For 2020, tori break say Jada Pinkett bin get affair with singer August Alsina while she dey married to American actor Will Smith.

Jada Pinkett tok am for one episode on her Facebook show, Red Table Talk say she get "entanglement" wit August.

Jada Pinkett bin dey address Will Smith, wey bin her guest ontop di Facebook show as dem dey tok about dia marriage mata.

For di 2022 Oscars, wen Will Smith win di award of Best Actor in a leading role for di feem King Richard, Chris Rock wey be comedian tok one joke for stage about Jada Pinkett “alopecia” health condition.

Will Smith comot from wia im siddon go slap Chris Rock for stage, say make di comedian comot mouth for im wife mata.

Afta di show, Will Smith beg Chris Rock say di slap dey “unacceptable".

Will Smith bin resign from di Academy of Motion Picture Arts & Sciences as dem ban am from Oscars event for anoda ten years.

Who be Jada Pinkett and Will Smith?

Jada Pinkett start her career for Hollywood for 1987, wen she feature for “A Different World”. She also feature for oda movies like The Nutty Professor, Madagascar, and Girls Trip. Recently, di actress dey popular becos of her Facebook show, Red Table Talk, wey air for four years between 2018 to 2022.

She be di mother of two out of three Will Smith children - Jaden Smith and Willow Smith.

Will Smith, na popular American wey don win four Grammy awards and Oscars. Di Hollywood star get three pikin, one with Sheree Zampino, wey im divorce for 1995.

Im pikin with Zampino na Trey Smith.