Nigerian workers enta street to protest against goment - why NLC dey protest?
Di protest wey di Nigeria Labour Congress dey organise hold across di kontri.
Nigerian workers protest for key cities across Nigeria including Abuja, Lagos, Port Harcourt, Ibadan, Kano and oda parts.
Workers gada for different places across di kontri wit placards wey carry some of dia demands to goment.
Dis protest dey happun afta di meeting between di Federal Goment and di organised Labour wey happun Monday night no end well.
Di meeting bin hold for di State House Abuja without tori pipo and e end without agreement from di two parties.
Na Secretary to di Goment of di Federation, George Akume lead di goment delegation - Attorney General of di Federation, Lateef Fagbemi; Ministers of Labour, Agriculture, Finance, Budget and Planning and di Head of Service of di Federation also dey dia.
While NLC president, Joe Ajaero lead im pipo go di meeting, Festus Osifo lead di delegation of di Trade Union Congress (TUC).
Di organized Labour for Nigeria bin call for protest over rising cost of living, inflation and oda welfare mata dem wey dey affect workers. Dem tell federal goment to increase minimum wage wey dey way below $20.
End of Di one wey oda users dey read well well




Di labour union dey call for more action from di goment as tins dey hard for di kontri.
Currently one litre of petrol dey cost more dan three times di price nine months ago.
Di price of food wey pipo dey chop evriday like rice, don pass double di price of last year.
Dis two figures show di kain hardtimes wey many Nigerians dey face.
Dem neva officially increase salary wey go fit help pipo manage to survive di cost of living wey dey rise.
Like many kontris, Nigeria dey experience economic shocks wey dey come from beyond in recent years.
But specific issues dey too wey Nigeria hand dey inside, and one of dem na di economic reforms wey President Bola Tinubu introduce wen im enta office for May, 2023.
How di economy bad reach now?
Overall, annual inflation, wey be di average rate wey prices of tin dey take go up, dey near 30% now - di highest figure for nearly 30 years.
Di cost of food don rise well well - by 35%.
However, di monthly minimum wage, wey goment set and wey all employers supposed to follow, neva change.
Na since 2019 goment put am for 30,000 naira - dis na just $19 (£15) for di current exchange rates.
Many pipo dey go hungry, dem dey ration di food wey dem get and dem dey also look for cheaper alternatives.
In northern Nigeria, some pipo dey eat di rice wey dem dey troway from factory during di milling process. Dem dey usually use dis bad rice to feed fish.
Pipo share am well-well for social media videos wey show how some pipo dey reduce di sizes of food wey dem dey chop.
One clip show one woman wey dey cut fish into nine pieces instead of di average four to five pieces.
Dem hear her as she dey tok say her goal na to make sure say her family fit eat fish at least two times a week.
Wetin dey cause dis economic crisis?

Inflation don rise for many kontris, as fuel and oda costs go up sake of di war for Ukraine.
But di efforts of President Tinubu to remodel di economy don also add to di burden.
On di day wey dem swear am in, nine months ago, di new president announce say fuel subsidy wey don dey for many years go end.
Di subsidy bin make petrol prices low for citizens of dis oil-producing nation, but na also one big avenue wey dey drain public finances.
For di first half of 2023, e account for 15% of di budget - more dan di goment spent on health or education.
President Tinubu argue say e beta make dem use di money for oda aspects of goment.
However, di way wey di price of petrol dey cause di oda prices of tins to rise as companies dey use transportation and energy cost to add for di prices wey di consumer dey buy.
Anoda factor wey dey cause inflation to rise na di issue wey President Tinubu inherit from former president, Muhammadu Buhari, according to financial analyst Tilewa Adebajo.
Im tell di BBC Newsday programme say di former goment bin ask di Central Bank for short-term loans to cover spending wey amount to $19bn.
Di bank print di money, wey help fuel inflation, Adebajo tok.
How food don rise for Nigeria?

Wia dis foto come from, Nigeria Bureau of Statistics/ BBC
Wetin NLC and TUC dey demand from Goment?

Since President Bola Tinubu enta office remove fuel subsidy, di Trade Union Congress (TUC) and Nigeria Labour Congress (NLC) neva keep quiet.
Dem dey drag Oga Tinubu to chook eye for di mata of workers.
Some of di tins wey di labour union dey demand na:
- Generate employment through massive investment in Agriculture and value- added manufacturing.
- Give farmers subsidy sharp sharp to boost agriculture and food security.
- Open all di places wey dem dey store food and share am equally across di kontri.
- Fix di factories wey dem don abandon, revive local production and patronise 'Made in Nigeria' goods and services.
- Repair all di four refineries sharp sharp as a mata of ntional priority.
- Make electricity( light) and water dey available to evribodi. Make e also dey affordable and accessible.
- To invest for road/ rail transportation and social housing.
- Bring cheap mass transportation buses wey dey use Compressed Natural Gas (CNG) sharp sharp.
- Stop to 'dollarize' di Nigerian economy and make goment stop wasteful spending.
- Fund education and healthcare for all levels.
- Provide beta social security for old and vulnerable pipo.
- Pay all di money dem dey owe workers and pensioners for all di levels of goment.
- Make dem fast track negotiation and implementation of new national minimum wage.
- Make dem abandon International Monetary Fund and World Bank policies sake of say e dey bring hardship to Nigerians.
















