Coup leaders stop attempt by Niger president to 'escape' go Nigeria

Wia dis foto come from, Getty Images
Di military junta for Niger say dem frustrate attempt by di removed president Mohamed Bazoum and im family to escape house arrest.
For statement dem read on di state TV on Thursday, tok-tok pesin for di junta say oga Bazoum and im family bin don make plan to escape di presidential palace by car around 3am for morning.
Di junta say dem bin plan to drive go di northern outskirts of di capital Niamey.
Dem claim say two helicopters wey belong to one foreign power wey dem no wan mention im name bin plan to carry dem go Nigeria.
"Di overthrown President Mohamed Bazoum and im family, im two cooks and two security elements, bin try escape from im place of detention," e tok.
Di escape plan scata and we don arrest "di main actors and some of di accomplices" e add.
Di big plan wey dem get na say Oga Bazoum go hide for one corner for di outskirts of di capital Niamey, Oga Abdramane tok.
Di group then plan to fly out on helicopters "wey belong to one foreign power" towards Nigeria, e add.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di junta congratulate di Nigerien armed forces for foiling di escape.
Dem add say dem don arrest di main pipo wey dey involved for di plan and dem don launch investigation.
For now, e no clear wia dem dey hold di former president and di rest of di group. Investigation into di mata don start.
President Bazoum don dey under house arrest since members of di presidential guard stage a coup in late July.
Mr Bazoum don refuse to officially resign.
Even under im captivity, e don publish one article for The Washington Post wia e tok say dem dey hold am as hostage and add say di coup go get "devastating consequences for our kontri, our region plus di entire world".
Soon afta dem overthrow Bazoum, US President Joe Biden bin call for im "immediately release", and for di "preservation of Niger hard-earned democracy".
Also, di junta don tell dia former colonial power France, as well as di UN to comot from dia kontri.
Regional power di Economic Community of West African States (Ecowas) don also attempt to intervene for di matter but e neva work.
Chairman of Ecowas and Nigeria president Bola Tinubu don try use different strategy to make di junta return power to civil rule – dat one sef don fail.
Niger na one of di allies of di West for di Sahel region wey terrorist groups dey worry, wey include fight wit groups wey dey close to Al Qaeda and IS.















