Mbappe double carry France enta Quarter final ahead of Poland

Wia dis foto come from, Getty Images
France don become di third kontri to enta di quarter final stage of di Fifa world cup for Qatar.
Le Bleus beat Poland 3-1 courtesy of two goals from Kylian Mbappe and anoda one from Olivier Giroud.
Robert Lewandowski later convert a last minute penalty for Poland but e no dey enof to save dem.
Only 13 players don ever score more World Cup goals dan Kylian Mbappe nine (in 11 games).
Six of doz players dey on 10 - so e just dey one behind dem.
Mbappe also overtake Cristiano Ronaldo (eight goals in 20 games) and Diego Maradona (eight goals in 21 games).
90+10mins: FULL TIME - France 3-1 Poland
90+9mins: GOAL! Goal! Robert Lewandowski
90+7mins: PENALTY to Poland afta VAR review
90+3mins: Robert Lewandowski get accurate pass deep into di box and attempt to fire di ball pass di keeper.
90+2mins: SUBSTITUTION. Axel Disasi enta for Jules Kounde.
90+1mins: GOAL! Kylian Mbappe score again for France
89mins: YELLOW CARD. Matty Cash chop card
88mins: Piotr Zielinski send ova free kick from long range but dey defence dey alert.
88mins: Youssouf Fofana deprive im opponent of di ball.
87mins: SUBSTITUTION. Jan Bednarek enta for Jakub Kiwior.
86mins: Kylian Mbappe give away a foul for bad challenge.
84mins: Attendance di Al-Thumama Stadium na 40, 989.
82mins: Robert Lewandowski escapes wit out any punishment from di referee afta using excessive force to foul im opponent.
81mins: Nicola Zalewski too violent for im attempt to get di ball from France
79mins: Arkadiusz Milik try to hold on to through ball, but e too long.
76mins: SUBSTITUTION. Marcus Thura menta for Olivier Giroud.
74mins: GOAL! Kylian Mbappe score second goal for France
72mins: Kamil Glik lose im marker and get on di end of di free kick.
70mins: E be like say Dayot Upamecano (France) saw red with that tackle. Jesus Valenzuela won't tolerate such behaviour on the pitch and blows for a foul.
68mins: Przemyslaw Frankowski whip beta cross into di box, but opposition defence intercepts di ball.
66mins: What a miss! Olivier Giroud no fit convert ball in fron to goal.
67mins: SUBSTITUTION. Youssouf Fofana enta for Aurelien Tchouamen
64mins: SUBSTITUTION. Sebastian Szymanski enta for Arkadiusz Milik (Poland).
64mins: Kylian Mbappe hold on to an accurate pass deep into di box and attempt to fire di ball pass di keeper, but the shot go off target.
63mins: France keep di ball and dey display some tiki-taka style passing
60mins: One of di defenders react at di last minute to block a pass from Jakub Kaminski
58mins: Wojciech Szczesny dey down injured and di referee stop play so e fit receive medical treatment.
57mins: Antoine Griezmann swing di corner, but fail to find any of im teammates.
55mins: Antoine Griezmann fail to find any of im teammates inside di box as dem block im pass.
53mins: Poland dey show team understanding – dem dey pass di ball around.
50mins: Di fall to Theo Hernandez on di edge of di box but im shot go wide.
47mins: Antoine Griezmann make good strike from di free kick just outside di box. Wojciech Szczesny save am.
45mins: Second Half
HALF-TIME
France 1-0 Poland
44mins: GOAL! Olivier Giroud score for France
44mins: Theo Hernandez sends cross into di box, but di opposition defence clear di ball to safety.
43mins: Some patient build-up play from France as dem look to unlock di defence.
40mins: Grzegorz Krychowiak collect ball from im opponent and explode in anger.
38mins: Hugo Lloris make a great save to deny Piotr Zielinski goal.
37mins: Dayot Upamecano commit foul and Jesus Valenzuela immediately signal for free kick.
36mins: Referee award corner and Antoine Griezmann go take am.
36mins: Kylian Mbappe get inside di box and try to beat Wojciech Szczesny wit im shot wey hit di left side of di net.
35mins: Matty Cash go from di edge of di box, but na harmless effort
33mins: Robert Lewandowski unleash shot from mid-range free kick but France wall stop am
32mins: YELLOW CARD. Aurelien Tchouameni chop card for harsh foul.
30mins: Ousmane Dembele slide brilliant pass into Olivier Giroud but e no get chance to hit am well.
27mins: Kylian Mbappe look to break free, but Poland player clear di ball comot.
26mins: Ousmane Dembele make a rough challenge.
24mins: Di actual number of corner kick for dis match na – 4:0.
22mins: Jules Kounde consider shot from di edge of di box afta receiving accurate pass. Wojciech Szczesny make comfortable save to stop di effort.
21mins: Robert Lewandowski find him sef unmarked on di edge of di box, but e drags im shot just wide of di right post.
18mins: Robert Lewandowski over-hit cross to di back post.
17mins: Ousmane Dembele attempt a low effort to di middle of di goal, but di goalkeeper make a comfortable save.
16mins: France players dey exchange short passes in dia attempt to create a shooting opportunity.
13mins: Robert Lewandowski commits rough foul.
11mins: Kylian Mbappe swing cross into di box, but e far too close to Wojciech Szczesny.
9mins: Wojciech Szczesny intercept di corner from Antoine Griezmann.
7mins: Bartosz Bereszynski do im best to hold di ball but e too long and it go out of play.
4mins: Raphael Varane jump pass im marker inside di box and head di ball go corner.
3mins: Ousmane Dembele attempt to find im teammate wit a final pass from outside of di box, but one of di defenders clear di ball to safety.
1min: Bartosz Bereszynski makes aggressive challenge and Jesus Valenzuela blows for a foul.
1min: KICK OFF
First Half
France vs Poland line up;

Wia dis foto come from, Getty Images
France: Lloris, Kounde, Varane, Upamecano, Hernandez, Tchouameni, Rabiot, Dembele, Griezmann, Mbappe, Giroud.
Poland: Szczesny, Bereszynski, Glik, Kiwior, Cash, Krychowiak, Zielinski, Szymanski, Frankowski, Kaminski, Lewandowski.
France vs Poland team news;
France coach Didier Deschamps no fear to use fresh players for dia last game against Tunisia – dis na becos na dem first qualify to di round among di oda teams.
As for Poland, Michniewicz get all im men available for di knockout battle.
However, at least six of dia players risk to miss dia next match if dem qualify. Dat na if dem collect yellow card for today game wit France.
Dey refresh dis page for live updates of dis match






