Three reasons why Kim Jong Un and Vladimir Putin fit wan be friends
North Korea leader Kim Jong Un dey Russia to meet president Vladimir Putin.
Both nations fit dey useful to one anoda and also get some tins in common, from enemies wey dem dey share to dia reliance on China.
Di BBC Russia Editor, Steve Rosenberg and Seoul correspondent Jean Mackenzie chook eye inside why di two kontris fit wan be friends.
Which kain weapons North Korea fit give Russia?

Wia dis foto come from, Reuters
In July, Russian Defense Minister Sergei Shoigu bin pay a visit to Pyongyang as dem dey celebrate dia key anniversary.
Dat meeting be like wen pesin go shop becos dem bin give Shoigu a flashy tour of North Korea weapons.
Kim also show off North missiles including di Hwasong intercontinental ballistic missile (ICBM) – and Russia need a lot of dem in dia war against Ukraine.
North Korea, wey be one of di most heavily militarised kontris in di world get plenty to spare.
Di most likely weapons dem go offer Russia na bullets, shells, and even old missiles, Kim Dong-yup, a professor for di University of North Korean Studies, tell di BBC.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di kontri get tens of millions of artillery shells and rockets, according to some estimates. Analysts believe dem no dey shake on di basis of weapons wey dey available becos di North neva fight a war since di Korean War end in 1953.
Prof Kim say handing these older munitions to Russia no go affect di defence capabilities of North Korea – for one recent military parade, dia army appear to dey armed wit new weapons.
Pyongyang firearms dey also largely based on Soviet weapons systems. Wey make North Korean munitions, to a large extent, compatible wit Russia arsenal.

Wia dis foto come from, Reuters

Wia dis foto come from, Reuters
Di Russian president tok for di economic forum for Vladivostok, Russian state media agency Tass report.
E say Russia dey developing weapons wit "laser, ultra-sonic and radio-frequency arms".
Putin dey tok for di Eastern Economic Forum, one annual meeting wey aim to encourage Chinese investment in Russia Far East.
Kim meeting wit Putin dey expected to take place afta di forum conclude on Wednesday, although di two fit meet for dinner beforehand.















