Protesters mount roadblock, destabilze activities for Abuja airport

Female protester wey waive NLC flag

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, File foto of one female protester wey waive NLC flag for Nnamdi Azikwe International Airport Abuja for 2022.

Plenty air travellers miss dia flights while local airlines also cancel some flights sake of one unusual incident for di Nnamdi Azikiwe International Airport, Abuja.

Protest by di Nigeria Labour Congress and di Trade Union leave many pipo stranded - dem protest for di airport entrance.

Tori bi say di labour union protest early mor-mor Thursday cause blockage for road as vehicles wey dey try carry passengers enta di airport premises dhook sake of traffic.

Plenti passengers now dey stranded sake of di matta.

One passenger, Siraj Abubakar, bin tell tori pipo say di Labour union protesters stop cars make dem no enter di Nnamdi Azikwe International airport from on Thursday.

"Dem bin stop us make we no enta di airport since around 8.30am. Dem say dem dey protest against di bad treatment of di NLC chairman for Imo State and I wonder how dat one take affects us here for Abuja," e tok.

Authorities for di Nnamdi Azikwe International Airport never tok anytin about di matta.

Nigeria Labour Congress protest for Abuja airport

Wia dis foto come from, NLC/X

Wetin we call dis foto, Nigeria Labour Congress protest for Abuja airport
NLC protest for Abuja airport

Wia dis foto come from, @crownjustices/X

Aviation Unions bin don declare joint suspension of flights to Owerri, Imo State South-East Nigeria, from evri airport inside di kontri from Wednesday.

Di reason na sake of one incident for Owerri last week wia di Labour Congress President, Joe Ajaero, dey allegedly dey brutalised.

Di National Union of Air Transport Employees, Air Transport Services Senior Staff Association of Nigeria, Association of Nigeria Aviation Professionals, and di National Association of Aircraft Pilots and Engineers, bin join hand drop one statement to announce dia decision to boycott flights to Owerri.

Di directive by di aviation unions dey in line wit di join-bodi of di National Executive Council (NEC) session of di NLC and TUC Wey shelle on Tuesday.

NLC President, Joe Ajaero bin face attack Owerri, for Imo State capital, last Wednesd just before a planned protest in the state to press the state government to heed the demands of the workers in the state.

The NLC and the TUC had since ordered shutdown of essential services for Imo as protest for di attack on Ajaero.

Dem declare make one nationwide strike start for 14 November, 2023.

On Wednesday 1 November, di Nigeria Labour Congress bin tok say some armed men wey wear security cloth carry dia President, Joe Ajaero for Owerri, Imo state, Southeast Nigeria.

Dem say di Imo state goment don kontinu to use di instrument of violence and intimidation’ against trade unions and dia leadership for di state.

Dem also say dem bin only ask di governor to pay di salaries wey e owe state workers, di labour joinbodi tok for statement wey NLC and TUC sign.

NLC and TUC bin condemn di detention of Ajaero den tell President Bola Tinubu to chook mouth for di mata.

“Just as Nigerian workers bin gather earlier dis morning led by di leadership of di two Labour centres to demonstrate our outrage over di serial and habitual abuse and violation of di rights of workers for di state, di goment unleash blood-curdling mayhem on di workers, dem add.