South African police dey investigate nightclub deaths

Wia dis foto come from, Reuters
South African authorities dey investigate di deaths of at least 22 young pipo inside a nightclub.
Dem find di victims for ground and ontop tables for di Enyobeni bar for di coastal town of East London.
Dem carri di bodies go mortuaries, wia post-mortem examinations - including toxicology tests - go seek to establish di cause of death.
South African President Cyril Ramaphosa express im "deepest condolences" to families of di victims.
"Dis tragedy dey made even more serious becos e happun during Youth Month - time during which we... advocate and advance opportunities for improved socio-economic conditions for di youth of our nation," e tok inside Tweet.
Oscar Mabuyane, premier of East Cape Province wia di tragedy happun, no give possible reasons for di deaths, but condemn di "unlimited consumption of liquor". Speaking for di scene, e say: "You no fit just trade in di middle of society like dis and tink say young pipo no go experiment."
Di incident happun early hours of Sunday. Di pipo dem find dia deadi-bodi dey between di age of 18 and 20.
One provincial safety official tell AFP news agency say dem rule out a stampede as di cause of death as dem no see "visible wounds".
"Forensic [investigators] go take samples and test to see if any poisoning of any sort happun," Unathi Binqose tok.









