'Dem say di bullet affect im kidney' - Papa of two-year-old wey die allegedly from NDLEA gunshot tok

Wia dis foto come from, Harrison Gwamnisu & Getty Images
- Author, Jelilat Olawale
- Role, Senior Broadcast Journalist, BBC Pidgin
Death of one two year-old boy for Delta State, south-south, Nigeria dey cause outrage across di west African kontri.
Ivan Omhonria die allegedly from injury e sustain from stray bullet wey some operatives of di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) shoot on Thursday, 13 July, 2023.
Di operatives according to one statement by di Agency bin go raid one joint for Okpanam area of Asaba wen di incident happun.
Ivan papa, Oga Fidelis Omhonria, tell BBC Pidgin say im second son also sustain injury as broken glasses enta im eyes- e dey recieve treatment for hospital alongside dia mama wey suffer shock.
Police for di state say dem dey aware of di mata.
Bright Edafe, toktok pesin for Delta police command in a tweet on Saturday say ''We don transfer di case to di SCID Asaba, and all parties involved go appear before di CP on Monday.''
My wife call to tell me how bad my pikin condition dey - Ivan papa
Oga Fidelis bin just drop im two pikin wey e go carry from school for im wife shop less dan five minutes before di incident wey lead to di death of two-year-old Ivan.
E say na Ivan mama ''call me say my baby intestine dey come out, say make I dey come over and I quickly turn my car around,'' Oga Fidelis tok.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di grieving papa say even though im wife bin call am to change im route to di hospital, e decide to still go straight to di shop wia di incident happun to understand wetin really happun.
E say na wen e get to di shop some pipo tell am say e be like say na bullet from gunshot wey dem hear from afar hit Ivan.
''Immediatey dem tell me dat, I come see some vehicles wey dem write NDLEA for dia body''
''As I dey try approach one Hilux vehicle wey belong to di NDLEA, I dey tell one officer say bullet from dia gun shot don kill my pikin''
''Di officer cock im gun and demand make I give am my phone wey I dey use record dem, as I no gree, dem quickly zoom off and I drive follow dem and begin dey call for help,'' E tok.
Oga Fidelis add say afta dem don drive for some time, di operatives stop and begin dey beg say dem bin dey ''shoot at some guys'' say na mistake.
E say e follow dem reach dia office wia dia oga tok plenti sorry and send some officers follow am go hospital wia dem dey treat Ivan and im one-year-old brother.
''Ivan bin still dey carry im school bag for back wen di bullet hit am,'' Oga Fidelis add.
E say di doctors for di hospital try dia best for about ''six hours'' before dem come call me say ''my boy no make am.''
''Dem say di bullet affect im kidney, intenstine, every dia bin shatter,'' e tok.
Ivan little broda also undergo operation for im eye and now dey recover for hospital.
Oga Fidelis say ''wetin I wan na justice for my son.''
Wetin NDLEA tok ontop di mata
Di Agency don begin investigate ''one shooting incident involving dia officers during di raid of a drug joint at Okpanam'
Di Oga of di NDLEA Brig. Gen. Mohamed Buba Marwa (Retd) say e don already ''set up a panel of top officials from di national headquarters for Abuja to immediately proceed to Asaba for on di spot investigate of di unfortunate incident with a view to establishing di actual facts of di case.
E tok dis for statement wey Femi Babafemi, toktok pesin for NDLEA release on Saturday.
Di statement say di initial incident report wey di Agency get show say:
“A team of NDLEA operatives bin carry out one intelligence-based raid of di joint of one notorious drug dealer wey dey for Okpanam area of Asaba at about 1600 hours on Thursday 13th July and for di process of di operation, one Toyota Camry 2008 model, light blue colour for di scene suddenly zoom off and jam one of our officers wey currently for critical condition, undergoing treatment for one hospital.''
Di report further say one dia officers after di car don jam im colleague come shoot im gun ''fire a shot aimed at di tyre of di car, wey eventually escape.
E add say after dem don rush di oficcer go hospital dem get ''reports of a stray bullet hitting one young pesin and dem immediately locate di papa of di victim, come follow am go di hospital and support am to facilitate di treatment but unfortunately die in di process,'' di statement tok.
Oga Marwa come ''assure di family and members of di public say we go get to di root of di case and take necessary action(s).”
Since di news of di incident hit di social media, plenti pipo across Nigeria don begin speak up as di thing dey vex dem.
Di incident make pipo para sotey #NDLEA don get over twenty thounsand tweets and dey part of di leading trend on Twitter on Saturday, 15 July.
#JusticeForOnose na pipo dey take call justice on Facebook.
Dia anger no dey too unconnected wit di fact say dem no too trust pipo in uniform sake of widespread bad experience wey many don suffer for dia hands-especially di police.
One Activist, Israel Joe on Facebook call on di authorities ''to get into investigations and unravel circumstances wey lead to di death of dis young boy and injury to im younger broda.
Anoda activist for Delta, Harrison Gwamnishu for im Instagram post say ''we no go keep quite''.














