Videos of Israeli hostages for Gaza wey thin like skeleton spark condemnation as Red Cross call for access

Wia dis foto come from, Reuters
- Author, Hugo Bachega
- Role, Middle East correspondent in Jerusalem
- Author, Mallory Moench
- Role, BBC News in London
- Read am in 5 mins
Western leaders don condemn videos of Israeli hostages wey thin, wey dia captors for Gaza record, as Red Cross dey beg make dem allow dem access to all di pipo wey still dey under captivity.
UK Foreign Secretary, David Lammy, tok say, "di kain image wey show hostages as dem dey parade dem for propaganda purpose na very wicked tin" and e demand say make dem release dem witout any condition.
Dis call dey come afta Palestinian Islamic Jihad release video on Thursday of Rom Braslavski, wey don lean and dey cry, on Saturday Hamas release anoda video of Evyatar David, wey also thin well-well.
Israeli leaders don accuse Hamas say dem dey starve hostages.
But Hamas armed wing deny say dem dey do am purposely, dem tok say di hostages dey chop di same tin wey dia fighters and civilians dey manage chop as hunger dey worry eviri bodi for Gaza.
Tori from Gaza tok say Palestinians wey dey try find food near wia dem dey share aid on Sunday, collect bullet from Israeli soldiers for two different places. Gaza hospitals tok say at least 27 Palestinians die for di incident.
Di Israeli hostages Braslavski 21, and David 24, na from Nova music festival Hamas carry dem on October 7, 2023 during di attack wey dem do for southern Israel.
Dem be part of di 49 hostages wey remain, out of di 251 wey Hamas carry initially. Israel talk say out of dis 49, dem believe say 27 don die.
Afta di videos come out, Prime Minister of Israel, Benjamin Netanyahu, call di two families of di hostages e tok say e dey deeply shocked, and promise say di effort to bring back all di hostages "go continue witout stopping".
On Sunday, Netanyahu also yarn wit di oga of Red Cross for di region, beg am to quickly help provide food and medicine to di hostages.
International Committee of di Red Cross (ICRC) tok say "dem shock well-well" afta dem see di video wey show say di hostages "dey suffer dangerous condition."
Di charity group come beg again make dem allow dem see di hostages, give dem medical help, and connect dem with dia families.
Hamas armed wing Al-Qassam Brigades tok say dem ready to allow Red Cross deliver food and medicine to prisoners, but only if dem open permanent and regular humanitarian road enter Gaza, and make dem stop airstrikes during di time wey aid dey enter.
But for Israel, many pipo don dey vex for Red Cross, dem accuse di organisation say e no try to help di hostages wey Hamas hold.
Earlier dis year, wen dem release some hostages as part of deal between Hamas and Israel, many pipo para becos of how Red Cross handle di mata, di group come explain say dem no get full power for conflict zones say dem dey rely on both sides to agree bifor dem fit operate.
Palestinians too dey vex, becos since October 7, 2023, Red Cross never visit Palestinian prisoners wey dey Israeli prison.
Over di weekend for Tel Aviv, plenty protesters and families of hostages come out again, dey beg Israeli govment to do evritin to release di hostages.
David and Braslavski families tok say "eviri bodi must comot from dis hell, now now."
For one of di videos, Braslavski dey cry as e tok say food and water don finish. E say di only tin wey e chop dat day na "three small crumbs of falafel". E tok say e no fit waka or even stand, say e dey near death.
Braslavski family come tok say "dem don break Rom," and beg both Israeli and US leaders make dem help bring dia pikin back.
"E be like say dem don forget am dia," dem tok.

Wia dis foto come from, Other
For di second video, David tok say "I never chop for days... I no even get drinking water well" and dem see am dey dig wetin e tok say go be im own grave.
Im family tok say dem dey "deliberately and wickedly starve am inside Hamas tunnels for Gaza – e don turn living skeleton, buried alive."

Wia dis foto come from, Other
German Chancellor Friedrich Merz tok say, e dey "appalled" by di images, and e add say to release all di hostages na compulsory condition before any ceasefire fit hapun between Israel and Hamas.
French President Emmanuel Macron, wey tok say Hamas represent "abject cruelty," add say France still dey work tirelessly to make sure hostages go free, restore ceasefire, and allow humanitarian aid enter Gaza.
E tok say dis effort must follow political solution, two-state solution "wey go make Israel and Palestine live togeda in peace." France recently announce say dem wan recognise Palestinian state, togeda wit Canada and UK, under some conditions. Israel don strongly condemn dis move.
Di images of dis thin hostages dey come out as UN-backed agencies tok say "di worst-case scenario of famine don dey hapun now" for Gaza, and pipo dey die from hunger eviri day.
Hamas-run health ministry tok on Sunday say, 175 pipo, including 93 children, don die from malnutrition since di war start.
Di UN, aid agencies and some Israel allies blame di hunger crisis on Israeli restrictions wey dey stop humanitarian aid from entering. Israel deny dis allegation and put di blame on Hamas.
Even wit all di evidence, Israeli authorities and part of di kontri press still strongly reject say starvation dey Gaza, and say na lie Hamas create and international media help spread am.
Some pictures of lean children don dey appear for protest wey Israeli pipo dey do, as dem dey beg govment to make deal with Hamas, but many pipo for Israel still no know how serious di emergency be.
As di war dey go on, Israel dey face more international isolation, as di heavy destruction for Gaza and di way Palestinians dey suffer dey provoke pipo.
Polls wey dem do for many parts of di world dey show say public opinion don dey turn against Israel, and e dey put pressure on world leaders to act.







