Gabon Coup: 'Make noise' - Ali Bongo call on supporters for help

Wetin we call dis Video, 'Make noise' - Ali Bongo call on supporters for help

Gabon president don call on "friends all over di world" to "make noise" over di coup for Gabon, inside one clip wey dey circulate on social media.

E siddon for wetin e call im residence - inside pne grand room complete with wood-panelled walls, ornate carpets and leather-bound books - Ali Bongo say: "My son dey somewhere, my wife dey anoda place.

"Nothing dey happun. I no know wetin dey happun."

E again urge im "friends" to speak up, before e come thank dem.

A communications company wey bin dey work for di presidency during di election don dey in contact with di BBC to confam di authenticity of di footage. Na Oga Bongo office ask make dem to circulate di video.

Notably, Bongo speak for English. Di official language of Gabon - wey be former French territory, from wia dem gain independence for 1960 - na French.

Ali Bongo family under house arrest - military

Wetin we call dis Video, Gabon army officers announce takeover on national television

Gabon President Ali Bongo Ondimba wey dem comot from power dey under house arrest, di AFP news agency dey quote military officers.

"President Ali Bongo dey under house arrest, surround by im family and doctors," dem tok for one statement read out on state TV.

One of di president sons don chop arrest for "treason", di statement reportedly add.

Army officers appear on national television earlier for Gabon to say dem don take over power.

Di officers for di announcement say dem don cancel di results of Saturday election, wia di electoral body declare Oga Bongo as di winner.

Di electoral commission say oga Bongo bin win di election wit just under two-thirds of di votes for election di opposition argue say mago-mago full inside.

E overthrow from power go end im family 53-year reign in power for Gabon.

12 sojas bin appear on television shortly afta di announcement of di election results, dem cancel di results of di election and dissolve "all di institutions of di republic".

One of di soldiers tok on TV channel Gabon 24 say: "We don decide to defend peace by putting an end to di current regime."

Im add say dis move dey down to "irresponsible, unpredictable governance wey don continue to worsen social cohesion and risk dey say e fit lead di kontri into chaos".

Oga Bongo come into power wen e father Omar die for 2009.

For 2018, e suffer stroke wey sideline am for almost a year and lead to calls for am to step aside, but e still remain.

Di following year, one coup attempt wey fail see di goment send di sojas wey organise di mutinyi to prison.

Dis na di latest coup wey don happun for Africa afta sojas seize power too for Niger Republic one month ago.

Mali, Burkina Faso don also witness coups recently and na military Juntas dey lead dia goments presently.

Ali Bongo profile

Ali Bongo

Wia dis foto come from, Reuters

Ali Bongo na man of many faces.

To some, na spoilt, playboy prince wey see ruling di oil-rich Gabon as im birthright; a one-time funk singer wey step into im papa shoe to continue im family's 50-year rule.

To odas, na reformer - a man wey, dem go argue, dey voted into power democratically by di masses.

Dem born Ali Bongo real name Alain Bernard Bongo for neighbouring Congo-Brazzaville for February 1959.

But even im birth dey controversial. Rumours, wey dem always deny, don persist for years say na so dem adopt am from di Nigerian south-east for di time of di Biafran war.

Di young Alain Bernard still dey for primary school wen im papa Omar Bongo take control of Gabon for 1967. Already, however, di groundwork bin dey laid for criticisms wey go haunt am later in life.

"Dem no born am for di presidential palace, but almost. E dey about eight wen im papa become president," François Gaulme, ione French historian and author on Gabonese politics, tell di BBC.

For di age of nine, dem send Ali Bongo to a private school for di upmarket Paris suburb of Neuilly, and later, to di Sorbonne wia study law. Dis international upbringing lead many for Gabon to see am as an outsider.

Alain Bernard become Ali and im papa Omar for 1973, after dem convert to Islam - di only members of dia family to do so.

Di decision dey widely seen a way to attract investment from Muslim kontri. But di elder Bongo, wey dey previously an animist and no dey baptised for di Christian faith, also evoke spiritual reasons for im conversion

Gabon country profile

Map

Gabon, wey dey di west coast of Africa, don get just three presidents since dia independence from France for 1960, with Omar Bongo ruling as president for more dan four decades until im death for 2009.

During im presidency, Gabon maintain close relationship with France under a system wey dey known as "Francafrique", receiving both political and military support in exchange for business favours.

But relations don cool since im son Ali win a contested election for 2009 and di French authorities launch a long-running corruption investigate into di family assets.

Gabon na major oil producer but a third of dia population live in poverty, according to di World Bank.

GABONESE REPUBLIC: FACTS

Capital: Libreville

Area: 267,667 sq km

Population: 2.3 million

Language: French

Life expectancy: 64 years (men) 69 years (women)