Police officer shoot Nollywood actor for neck during party

Foto of Ijaduade Ololade Azeez

Wia dis foto come from, Ijaduade Ololade Azeez/Instagram

One trigger-happy police officer don shoot and injure one Nigerian Yoruba actor, Azeez Ijaduade for Ogun state.

Di incident happun on Saturday wen di officer shoot for air.

Di bullet hit di actor for neck afta di police officer open fire during Bramaj Company end of year party for Napoli hotel.

Di mobile police officer bin dey attached to one Chinese expatriate.

Wen e bin shoot into di air, di bullet go hit di actor.

One of di actor colleague, Abiodun Adebanjo for im Instagram page on Sunday morning confam am.

"Abeg we need help for Peru. Di police don shot my film director, Azeez Ijaduade, and im dey Babcock University Teaching Hospital,” Abiodun Adebanjo tok.

According to di update from Oga Adebanjo, im tok say dem don carry di actor go teaching hospital for Ilishan and im dey respond to treatment.

“We no need donation, We wan assure di world say im dey do well and evritin dey under control, if we need anytin we come come ask una,” Adebanjo tok.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

Meanwhile, police say di police officer attached to di Chinese expatriate “unfortuanately” shoot “ammunition shell wey hit Azeez Ijaduade for neck”, during one company end of di year party for Ogun state.

Di state police tok-tok pesin, Odutola Omolola on Sunday tok say di hotel manager Fakoya Adewale report di incident to Iperu divisional police officer say dem don shoot for di hotel around 11:24 pm.

Ms Odutola confam say dem don identify di mobile police officer and dem go soon start investigation into di shooting incident.

“Di Ogun State police command don receive one report of shooting incident on di 23 of December 2023 around 11:24 pm from one Fakoya Adewale “m” Napoli Hotel manager for Iperu wia im report to di Divisional Police Officer say during Bramaj Company end of year party for di hotel, one mobile policeman attached to Chinese expatriate expend shot into di air and unfortunately di ammunition shell hit one Azeez Ijaduade, actor for neck,” Ms Odutola tok.

“We don identify di mobile police officer and investigation into di shooting incident go start by di command.”

She add say di commander mopol 16 don contact di actor and also visit am for hospital wia dem go soom discharge am.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post