Wetin be di G20 summit wey dey happun dis week and wetin leaders dey tok about dia?

One woman waka pass di G20 Indonesia summit logo for Jakarta

Wia dis foto come from, Getty Images

Di leaders of di kontries wey make up di G20 dey meet for dia annual summit for Bali, inside Indonesia, on 15 November.

Di main aim na to find ways to help di world economies recover from di Covid pandemic - but tensions ova Ukraine war fit disturb di tok-tok.

Wetin be di G20 and why dem form am?

G20

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Banners for di G20 summit inside Bali, Indonesia

Di G20, or Group of Twenty, na club of kontries wey dey meet to discuss plans for di global economy.

Between dem, G20 kontries dey account for 85% of di world economic output and 75% of world trade. Dem contain two-third of di global population.

Di members na di European Union and 19 nations wey be:

Argentina, Australia, Brazil, Canada, China, France, Germany, India, Indonesia, Italy, Japan, Mexico, Russia, Saudi Arabia, South Africa, South Korea, Turkey, UK and US.

Dem dey always invite Spain as guest.

One smaller group form di G7 group of leading industrialised nations.

G20
Wetin we call dis foto, Chart wey show key numbers of di G20 group.

Wetin di group dey discuss?

Di mata wey di G20 leader summit dey discuss don dey wide from economics to include climate change, sustainable energy, international-debt forgiveness and ways to tax multinational corporations.

Every year, one different G20 member state dey take ova di presidency and set di agenda for di group meetings.

As 2022 president, Indonesia want di Bali summit to concentrate on global health measures and economic recovery afta di pandemic.

Dem also want to promote di way kontries dey adopt sustainable energy.

Di summit na also opportunity for national leaders to meet on di sidelines for one-to-one discussions.

Ahead of di summit, US president Joe Biden meet with Chinese leader Xi Jinping to discuss some issues including di war for Ukraine and di status of Taiwan.

Who dey attend?

Political tension fit overshadow di summit.

Ukraine foreign ministry don request make dem expel Russia from di G20 because of dia invasion of Ukraine.

Indonesian goment don bin tok say President Putin no go attend in pesin.

Many pipo dey also feel say US President, Joe Biden go refuse to greet Saudi Arabia Crown Prince, Mohammed bin Salman.

President Biden bin don bin accuse Saudi Arabia of helping Russia to finance dia war inside Ukraine and say di two kontries dey togeda to keep crude oil prices high.

Why dem dey always snap 'family foto'?

Di heads of goment dey always pose togeda to snap one group foto.

Dem dey use am as opportunity to sell whatever agreements di leaders don sign.

But often times, di diplomatic disagreement wey di foto dey reveal dey make headlines.

For instance, for 2018, afta di killing of journalist Jamal Khashoggi for di Saudi consulate for Istanbul, dem ignore Prince Mohammed bin Salman for di leader summit.

Dem make Prince Mohammed bin Salman stand for di far end of di group for di family foto.

G20

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, US president Joe Biden fir refuse to meet Saudi Crown Prince Mohammed bin Salman for di summit

Di G20 don dey successful?

For di 2008 and 2009 leader summits, during di great financial crisis, leaders agree for some measures to rescue di global financial system.

But future summits don dey less positive, argument dey, because tensions between rival world powers spoil am.

For dis year meeting of G20 finance ministers and central bankers, dem no too agree on plenti tins because of arguments between Russia and Western powers ova di invasion of Ukraine.

However, nations dey often reach agreement by meeting on di side-lines of summits.

For 2019, for Osaka, di US president den, Donald Trump and China President, Xi Jinping, agree to resume tok-tok to settle one major trade dispute.

G20

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Riot police clash with protesters outside di G20 summit for Hamburg, for 2017

Often times, big protest dey take place around di leaders summits.

Thousands of demonstrators march for Buenos Aires for 2018 to protest against di G20 economic policies.

Anti-capitalist protesters riot around di 2017 summit, for Hamburg, and thousands of demonstrators march during G20 summits for Rio de Janeiro, for 2018, and Toronto, for 2010.

For 2009, dem kill one newspaper seller, Ian Tomlinson.

Ian Tomlinson bin dey go back home from work wen e waka jam di protests against di G20 summit for London.

Full membership of di G20: Argentina, Australia, Brazil, Canada, China, France, Germany, India, Indonesia, Italy, Japan, Mexico, Russia, Saudi Arabia, South Africa, South Korea, Turkey, United Kingdom, United States and di European Union.