Di Nigerian king wey no fit see im mama wen she dey alive or her deadi-bodi

For Yoruba land, evri town get taboo, wey dem no suppose do, even for kings.
Among di towns for Yoruba land na Odo Owa, one town for Oke Ero local goment area of Kwara State, north-central Nigeria.
For any pesin wey become king, for Odo Owa, e dey forbidden for am to see im mama, weda she dey alive, or wen she die.
Olota of Odo Owa town, King Joshua Adegbuyi Adeyemi, Aniyeloye II, tell BBC Yoruba say e no dey allowed to see even im mama deadi-bodi.
Di king no also fit see any oda dead-bodi.
Apart from dis, e dey forbidden for di king to see new born pikin even if na di pikin wey im wife born, until di child reach six months old.
Di monarch say na im be di second king on di throne for di town wey im mama still dey alive during im reign.
"Once Olota don ascend di throne, e dey forbidden for am to se im mama alive or wen she die."
End of Di one wey oda users dey read well well
E tok say since di day Iwarefa don carry am comot from di middle of di night and collect di wrapper wey im mama use take tie am wen e dey small from im mama, na dat day dem see each oda last until im die for 2023.

E get oda taboos wey dey attached to di Olota throne. King Adeyemi tok say e no dey eat some kain food.
Also, e no fit enta room wit woman during di day. E no dey allowed to farm becos e go bring suffering and poverty into di town if di king farm.
"Although na farming we dey do for our town, I no dey allowed to touch di plow. If I do am, poverty go befall my pipo.
King Aniyeloye II tok say if e get di power to change anytin, e go stop di practice wey no dey allow king see im mother.
"If to say di chiefs agree say make I make modern changes, my mama go dey live wit me, becos no mata how old pikin be, im parent advice go pass im own wisdom."














