Supreme Court overturn Appeal Court judgement wey say Nnamdi Kanu no go stand trial

Nnamdi Kanu

Wia dis foto come from, Getty

    • Author, Tamara Ebiwei
    • Role, Broadcast Journalist, BBC News Pidgin
    • Reporting from, Abuja

Supreme Court of Nigeria don overturn di judgement of di Appeal Court wey say Nnamdi Kanu no go stand trial again due to di way wey dem use bring am come Nigeria.

Di panel of Judges of di Supreme Court say Nnamdi Kanu must continue im trial

Di leader of di Indigenous People of Biafra (Ipob) Nnamdi Kanu, im followers across di world and Nigerians bin dey wait to know im fate on Friday 15 December, 2023.

Nigeria highest court wey be di Supreme court of Nigeria deliver di judgement on di mata wey start since 2021 from di Federal High Court, Abuja.

Supreme Court judgement

Justice Emmanuel Agim wey read di lead judgement wey Justice Garba Mohammed prepare say goment commit illegalities against Nnamdi Kanu as dem invade Kanu house afta court grant am bail.

Dem still commit illegality wen dem go wia im dey, bring am to Nigeria by kidnap and abduction to face trial wey no follow di normal extrajudicial procedure.

But di court come say even though di process wey dem use bring Kanu dey illegal, e no mean say im dey free from trial.

Supreme Court tok say di judgement Court of Appeal bin give, wey tok say Nnamdi Kanu no suppose face trial again sake of di way dem use bring am, dey correct but dat one na international law.

Dem add say di Appeal Court judges fail to mention any legislation or law for Nigeria wey support dat claim.

Dem go further to explain say for Nigeria law, dat kain tin no dey, sake of say Nigeria law neva develop reach di level wey dem go throway case because dem use force arrest di alleged criminal.

"In case di police destroy di house of a suspect to obtain exhibits, e mean say we go troway di offence against di suspect?

Di solution na to follow civil proceedings. We no go fit stop proceedings sake of violation of di rights of di suspects, no be our law for now.

We decide not to go wit di Court of Cppeal. Even though we condemn di violation of im rights."

"Nigeria must redeem e image and respect di rule of law.

If dem bin don grant pesin bail, why una go go invade im house? Justice Emmanuel Agim ask.

E dey irresponsible, make una no blame am for running."

No legislation for dis kontri wey remove di trial court of di jurisdiction to go ahead wit Kanu case, despite di illegal action of di federal goment.

Di law must take it's course.

Di Court of Appeal dey wrong to to talk say di trial court (Federal High Court) no fit try am.

We allow di appeal and dismiss di cross-appeal." Justice Agim conclude.

Nnamdi Kanu hope of 'victory and freedom' no come to pass

Sake of say dis na di last day for di mata, pipo for di Nnamdi Kanu camp bin dey positive. Dem bin dey hope say di judge go rule in Nnamdi Kanu favour.

One of Nnamdi Kanu legal team members, Aloy Ejimakor bin tell BBC Pidgin say, "wetin we dey expect na victory and freedom"

“Today, we expect say di Supreme Court go rule say di extraordinary rendition dey fundamentally wrong as e constitute a permanent barrier to detain di victim or subjecting am to trial.

No oda option dey dan to free Nnamdi Kanu." Aloy add.

Wetin bin don happun so far

File foto of Nnamdi Kanu in court with im lawyers
Wetin we call dis foto, File foto of Nnamdi Kanu in court with im lawyers

For di last hearing of di mata for di Supreme court on 5 October, 2023, di panel of judges bin reserve judgement till 15 December, 2023.

For di hearing, counsel to di federal goment Tijani Gazali ask court to set aside di Appeal Court judgement wey free Nnamdi Kanu from criminal charges.

"We urge my Lords to set aside di judgement of di Appeal Court wey clear Kanu from standing trial and affirm di decision of di Federal High Court for Kanu to stand trial.

We urge di court to also dismiss di cross appeal for lack of merit." Gazali tok.

Meanwhile, former lead counsel to Nnamdi Kanu, Mike Ozekhome tell court to uphold di Appeal Court judgement.

"We urge di court to dismiss di main appeal and uphold di cross appeal in oda to do justice to dis mata so dat di respondent wey dey incarcerated since June 2021 go get justice.

Make court also use dis case to demonstrate say no man, goment or citizen dey above di law as dis case get global and international attention." E tok.

Mike Ozekhome also withdraw di motion e bin file on 8 Feb 2023 wia e file for transfer of Nnamdi Kanu from DSS hand to Kuje Correctional Centre.

Di second motion wey e withdraw na on 9 Feb 2023 e file am.

Di motion na for court to grant di respondent bail so dat e go dey alive to stand trial.

Anoda motion wey e withdraw na di one on accelerated hearing, so dat court go hear di case sharp sharp.

Ozekhome withdraw di motions sake of say e don dey overtaken by events.

"Court withdraw and strike out di motions". Justice Kudirat Kekere-Ekun tok.

Counsel to Nnamdi Kanu Mike Ozekhome, SAN bin file two motions, one na to release am on bail, di second na to transfer am from DSS custody to Kuje Correctional Centre, Abuja.

Meanwhile Court of Appeal for Abuja bin don discharge Nnamdi Kanu from all charges and also tok say e dey illegal to detain or continue to try am.

Goment go di same court of Appeal wia dem give dem 'Stay of Execution' order wey go continue to keep Nnamdi Kanu for detention till Supreme Court hear di mata.

Supreme Court suppose hear di mata since September 14, 2023 wey be di last adjourned date, but dem no sit again on dat day.

On May 11, di last day wey Supreme court sit sake of Nnamdi Kanu case, Supreme Court announce di adjournment afta counsel to Federal goment Tijjani A. Gazali oppose di hearing of two motions.

Di motion to grant Nnamdi Kanu bail and di motion to transfer am from DSS custody to Kuje Correctional Centre, sake of say im neva file im response.

Goment lawyer Tijani Gazali bin beg court to give am time till Friday 12 May, 2023 to file im response.

Counsel to Nnamdi Kanu Mike Ozekhome SAN, bin tell court say im dey ready for court to hear di mata but di judges say dem no go fit do anytin dat day.

Im bin beg di judges to give dem di nearest possible date sake of say di condition wey Nnamdi Kanu dey for DSS custody bin no good.