Key decisions President Tinubu make for emergency meeting wit govnors as cost of living bite harder

President Bola Tinubu of NIgeria

Wia dis foto come from, X/@officialBAT

Wetin we call dis foto, President Tinubu meet wit all di govnors for Nigeria

President Bola Tinubu don announce some key decisions wey go concern all Nigerians during im emergency meeting wit di 36 govnors of di kontri.

President Tinubu bin meet wit all di govnors for Nigeria on Thursday at di presidential villa to address di plenti wahala wey dey face Nigerians at di moment.

According to di president, im administration wan try find home-grown solutions to di challenges wey Nigerians dey face in times of food security.

President Tinubu tok decisions wey comot from di meetings wit di govnors and im major focus dey on how to develop local food production as well as how to end food importation.

On food security mata

President Tinubu tok say im hear reports of places for Kano and oda areas wey dem dey hoard food for warehouses in large-scale.

Im tok say di National Security Adviser, di Inspector-General of Police, and di Director-General of di Department of State Services go mobilise security agencies to go dey inspect and take actions ontop di warehouses.

Di president come take dis four decisions on food mata:

  • President Tinubu tok say im no go "allow speculators, hoarders, and rent seekers to spoil im efforts to ensure say food dey widely available to all Nigerians".
  • President Tinubu say im no go "establish a price control board and im no go approve di importation of food. Dis na sake of how importation go allow rent seekers to dey do fraud, according to di president".
  • Di president tok say im go "support farmers with schemes wey go encourage dem to cultivate more food for di nation".
  • President Tinubu say im administration go quickly implement livestock development and management as well as dairy farming.

Ontop security of lives and properties

  • Di president don approve di "creation of a committee wey go include state govnors and federal goment representatives to look how dem go possibly establish a state police".
  • President Tinubu say im don also 'endorse di training and equipping of forest rangers by state goments so dem go fit protect human and natural resources for our communities".

Dis mean say President Tinubu dey "aggressively" consider di establishment of state police.

Ontop monetary policy and CBN

President Tinubu add say im goment go try improve di revenue of di nation and also address di monetary policy wey dey go on for di kontri. Di president tok some decisions as e touch di CBN and oda monetary policy:

  • Di president tok say 'all di govnors gatz trust di Central Bank of Nigeria wit di management of di kontri monetary policy.
  • President Tinubu say fluctuation of di foreign exchange rates dey affect di market and na why anybodi wey dem assign to address am must to perform. According to di president, if di pesin wey suppose handle am fail, "we gatz find way to quickly remove dat pesin from di system".

Many Nigerians dey expect say dis meeting go bring plenti changes wey go make lives of di pipo beta and President Tinubu tok say all leaders gatz work togeda to achieve am.

Oda dignitaries wey dey di meeting include Vice-President Kashim Shettima, di National Security Adviser, di Inspector-General of Police, di Director-General of di DSS, and some ministers of di federation.