Wetin be di five new MOUs Tinubu goment sign wit China

Wia dis foto come from, Nigerian Presidency
Di president of Nigeria, Bola Tinubu don sign five memorandum of understanding (MOU) wit China president, President Xi Jinping to strengthen di economic relationship between both kontris.
Tinubu sign di documents on Tuesday, 3 September, during im official visit to China for di 2024 forum on China-Africa.
On Thursday 29 August, wen di president dey comot Abuja for China, Ajuri Ngelale wey be Tinubu tok-tok pesin say im oga go meet wit President Xi Jinping and some oda Chinese business leaders.
During dis trip, Oga Tinubu go also attend di 2024 forum on China-Africa cooperation wey go hold between September 4 and 6.
Di China-Africa forum na platform for cooperation between China and African kontris and e dey hold evri three years.
Wetin be di five MOUs wey both presidents sign
- Cooperation plan between Nigeria and China on jointly promoting di Belt and Road Initiative
- Memorandum of Understanding on cooperation in di peaceful application of Nuclear Energy
- Memorandum of Understanding on strengthening cooperation on Human Resource Development under di Global Development Initiative
- Memorandum of Understanding on Media Exchange and Cooperation
- Memorandum of Understanding between China Media Group and di Nigerian Television Authority
Nigeria and China agree on trade, technological and economical developmental programmes

Wia dis foto come from, Nigerian Presidency
President Tinubu tok say di relationship between Nigeria and China need to dey strengthened so e fit advance di kontris trade and economic development programmes.
Tinubu tok say e don take some reform measure to drive di kontri economy as China don modern demsefs as example
''We don recognise di need to reform our economy, and we dey do am diligently across tax and tariff reviews, to various oda segments of our nation economy,” President Tiunubu tok.
''Trading and investment partners go get easy access to bring in dia investments and seamlessly take dia resources out.”
President Xi tok say di relationship and understanding between Nigeria and China don dey in establishment ova di past 50 years.
Di Chinese president tok say China and Nigeria go bring fresh drive of progress to China-Africa relationship.
''We don find di di path of seeking collective strength, through unity, and win-win cooperation.
''China and Nigeria, as major developing kontris, strengthening strategic coordination, go inject fresh drive to China-Africa relations in di new era and carry common progress among Global South kontris,'' President Xi tok.

Wia dis foto come from, Nigerian Presidency
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Oda fotos from di meeting

Wia dis foto come from, Nigerian Presidency

Wia dis foto come from, Nigerian Presidency

Wia dis foto come from, Nigerian Presidency

Wia dis foto come from, Nigerian Presidency

Wia dis foto come from, Nigerian Presidency
Previous agreement wit China
For 2018, former president Muhammadu Buhari bin go China wia e sign some projects wey Chinese goment bin sponsor.
Buhari bin collect new loan of 328 million dollars from China.
Di former president bin dey China for di 2018 Beijing Summit of di Forum on Africa-China Cooperation.
For 2013, China bin agree to give Nigeria $1.1bn (£700m) low-interest loan to build infrastructures wey dem need.
Di deal na during former Nigerian president Goodluck Jonathan administration wen e meet wit Chinese President Xi Jinping for Beijing For July 2013.
Di money na to help build roads, airport terminals for cities, and a light-rail line for Nigeria capital.
During dat meeting, China bin dey invest heavily for Africa as e also rely on oil and oda natural resources wey dey di continent.
Jonathan bin lead a business delegation on a four-day trip to China den so Nigeria go fit boost ties wit di Asian kontri.










