Ghana authorities release dancehall musician Shatta Wale on bail afta e spend more dan 24 hours for detention

Shatta Wale performing at an event barechested

Wia dis foto come from, NIPAH DENNIS/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Di musician dey under investigation afta Eoco tok say FBI link im lamborghini to proceeds of crime for di US
Read am in 6 mins

Di Economic and Organised Crime Office (Eoco) don release dancehall musician Charles Nii Armah Mensah wey dey popular as Shatta Wale afta dem detain am for more dan 24 hours.

Dis dey relate to investigation by di crime office afta dem seize im Lamborghini Urus car early dis month.

Management of di musician don confam say dem bin release dia artiste on bail afta im meet di conditions.

Bifor, Eoco bin grant di 'Dancehall king' hitmaker bail for di sum of GH 10m cedis ($909k) wit two sureties to dey justified.

But im bin no fit meet di conditions and na why im remain for custody wey im continue to assist Eoco wit investigations.

"Now dem don finally release Shatta Wale wia im go house afta we meet di new bail conditions of GH5m ($455k) wit two sureties," tok-tok pesin for di management, Samuel Baah, tell journalists for di Eoco premises.

Im management add say "we bin tank di fans and evribodi wey don support us; to di fans and supporters of di musician, we tank una".

Why Eoco dey pursue di musician

According to Eoco, dem bin work togeda wit Federal Bureau of Investigation (FBI) for America to trace di Lamborghini car wey dem suspect say na proceed of crime.

Inside one statement at di time, Eoco explain say "FBI don link dis car to one criminal enterprise wey involve one Ghanaian Nana Kwabena Amuah, wey currently dey inside jail for di US as im dey serve 86 months for several financial crimes".

Di crimes office also add say di "FBI and di US justice department go send formal mutual legal assistance (MLA) to di Ghana govment to return di vehicle to di US as part of Nana Kwabena Amuah $4.7m restitution".

Even though di dancehall star bin deny all di allegations say im buy stolen car wey dey linked to di crime, Eoco tok say dem continue to invite am to assist wit investigation togeda wit one oda pesin wey be former senior officer for di kontri National Signals Bureau.

"I neva buy any car from di Ghanaian wey bin dey inside jail for di US. I be third party owner of di car wey I bin buy am for $150,000," Shatta Wale explain im side of di tori for TikTok live video.

Im add say, "I dey buy cars thru my team wey sometimes I neva even sabi who ship am sef."

A Getty image of a yellow Lamborghini Urus

Wia dis foto come from, MARTYN LUCY/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Shatta Wale say im buy di luxury car for $150,000 but Eoco say di artiste no get documents for di car, na only customs declaration document wey get di name Nana Kwabena Amuah wey currently dey inside jail for US.
Shatta Wale perform to a crowd at an event, jumping and showing energy on stage

Wia dis foto come from, ERNEST ANKOMAH/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Di musician recently dey part of high profile artistes wey perform for Vybz Kartel freedom street concert for Jamaica

Eoco detain di musician on 20 August

Shatta Wale accuse di boss of di Economic and Organised Crime Office at di time say im dey do "witch-hunt".

Di dancehall musician spend di night of 20 August in detention for Eoco.

Management of di artiste at di time assure di fans say make dem bin dey calm as dem dey work to secure im release.

"Eoco don detain Shatta Wale following investigation wey relate to tax obligation of di yellow Lamborghini car. Di artiste present imsef voluntarily to Eoco on Wednesday afternoon togeda wit im lawyer Cephas Biyuo to assist wit investigations."

Tok-tok pesin for di artiste Samuel Atuobi Baah write say, "We want assure all di fans and di public say di legal team dey fully in charge wey dem dey work wit authorities to deal wit dis mata."

"Eoco bin grant di artiste bail in di sum of Gh 10m wit two sureties."

Di PR manager further explain say di artiste bin dey in good spirit wey im dey cooperate wit investigations.

Di latest action by Eoco to detain di musician happun a day afta im clear anoda Lamborghini Urus car from di port.

Shatta Wale and im team bin celebrate wey dem pop champagne afta dem carry im new purple coloured Lamborghini to im house Tuesday night.

Videos of di car and di celebration bin go viral on top social media, as di artiste tok say "what I tok say I go do, I dey do am and do am so real".

Di dancehall artiste get plenty followers, na so anytin wey concern am dey fit cause kasala ontop social media.

Management tok say "we urge Shatta movement fans and well-wishers to dey calm and avoid speculation."

"We get confidence for di judicial process wey management and di lawyers go return to Eoco office Thursday morning to continue di discussion," di artiste tok-tok pesin add for di management statement.

Eoco insist say Shatta Wale get questions to answer

Di organised crime office inside fresh statement maintain say di Lamborghini car dey linked to proceeds of one $4m crime wey involve di Ghanaian wey dey inside jail.

Eoco also explain say, "Shatta Wale dey unable to identify di pesin wey bin sell di car to im, except wetin im tell us say im bin buy am from di street from pesin wey im name fit be ZAK.

"Di musician say im contact di pesin wey sell di car for WhatsApp but im neva remember di identity of di pesin wey im don throway di pesin contact."

Eoco further add say, "Shatta Wale neva get any document in terms of di receipt or transfer documents wey bin show say im dey own di car.

"Di only tin wey im get na custom declaration document wey don get di name Nana Kwabena Amuah wey currently bin dey inside jail."

Fans of di musician bin gather for di Eoco office all day on Thursday to put pressure ontop officers of Eoco.

Law enforcement officers
Wetin we call dis foto, Security bin tight for di Eoco office as fans gada to demand di release of di musician

Shatta Wale tank fans for dia support afta im release

Di dancehall artiste afta im comot di custody of Eoco don do TikTok live wey im tank im Shatta movement fans for dia support.

"I appreciate di love you all don show me. I neva take am for granted."

Di musician say, "I don tank evribodi wey don help to bail me and di media and bloggers wey make di mata travel far, na beautiful tin.

"As I bin dey tok, plenti pipo don dey join di live session to hear from me, I tank all of una."

Eoco premises
Wetin we call dis foto, Eoco say dem go continue to pursue di mata involving 'stolen cars' from di US and Canada wey FBI and oda authorities bin trace to di kontri

Di musician wey pipo know as 'dancehall king' afta im release song wit dat title for 2014, na ogbonge artiste for di kontri.

Im don release at least 11 albums and ova 60 songs for im career.

For 2019, Beyonce bin collaborate wit Shatta Wale on top one song 'Already' wey bin feature for her Lion King album.

Some of im most popular hits na 'Dancehall King', 'Taking Over', 'My Level' wey im don release anoda hit song togeda wit Medikkal and Beaztrap wit di title 'Shoulder'.

Im dey command ogbonge fan base wey dey call demsefs Shatta Movement

For December 2024, Shatta Wale na one of several global stars wey perform for Vybz Kartel freedom concert for Jamaica.