Protest plots, medical access - DSS drop latest informate ontop Emefiele mata

Wia dis foto come from, Collage
Di Department of State Services (DSS) say dem don identify pipo wey dey plan to organise protest to call for di release of di suspended Central Bank of Nigeria govnor, Godwin Emefiele.
Di Nigeria Secret Police for inside statement wey dia tok-tok pesin, Peter Afunnaya release, say di groups dey plan to gada for different points for Abuja and Lagos states dis week to hold di protest.
E say dem go carry placards wey go show di service and di goment for bad light plus call for di release of Emefiele.
“Di DSS don identify pesins and groups wey dey plan to stage campaigns of calumny against it plus di goment over di suspension and investigation of Mr Godwin Emefiele.” Di statement tok.
President Bola Tinubu bin suspend di apex bank govnor on 9 June and oga di DSS arrest am on 10 June, e still dey for di custody of di DSS as investigation dey go on.
One statement from di office of di Secretary of the Government of the Federation na im announce di suspension.
E say di suspension dey come sake of di ongoing investigation of im office and plan dem get to reform Nigeria financial sector.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Meanwhile, di DSS don warn say dem no go hesitate to arrest those wey dey plan di protest as dem dey monitor dia activities.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di secret police add say dem dey aware say some pipo dey use dia disloyal staff against di leadership of di service.
“Di Service dey aware of di cheap propaganda wey dey aimed at demotivating and distracting it from professionally executing di responsibilities assigned to it.
“E don also note di misleading commentaries, speculative narratives, storylines and videos wey dey circulate social media by uninformed parties, critics and/or desperadoes.” DSS tok.
'We don grant Emefiele access to medical officials' - DSS
Di secret service say dem allow di suspended govnor access to im family, medical officials and appropriate pesins wey suppose see am right from did ay dem arrest am.
“E dey instructive to state say di service don grant di family of Emefiele, medical officials and appropriate pesins access to him, right from di day dem carry am in and long before di court order requesting so.”
Dis dey come afta one Federal Capital Territory High Court for Abuja order di DSS to allow Emefiele access to im lawyers and family.
Why DSS arrest Emefiele
Nigeria Department of State Services (DSS) confam di arrest of Godwin Emefiele, di suspended Governor of di Central Bank of Nigeria (CBN), hours afta President Bola Tinubu suspend am.
Tok-tok pesin for di service Peter Afunanya confam im arrest inside statement.
E say im arrest na for some investigative reasons.
Di presidency bin say dem suspend di apex bank oga sake of di ongoing investigation of im office and plan dem get to reform Nigeria financial sector.
Emefiele bin don dey in di eye of di storm for months now afta di 'new naira note policy' dem launch just before di general elections for February cause kasala and lead to economic hardship for citizens as a result of naira scarcity.
Emefiele also bin dey face accuse say im dey run fraudulent activities, dey finance terrorism and also commit crime wey fit threaten national security. Accuse wey Emefiele don deny.
Despite DSS initial attempt, Chief Judge of di Federal High Court, Justice J.T Tsoho, no gree grant di DSS dia request to arrest am unto say e no come wit den president, Muhammadu Buhari approval. And na sometin wey fit throw Nigeria economy into deep crisis.














