Niger coup leaders and Nigeria intervention team 'agree to pursue dialogue'

Niger coup leaders and Nigeria intervention team agree to pursue dialogue

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Supporters of Niger National Council for di Safeguard of di Homeland (CNSP) wave Niger and Russian flags as dem demonstrate for Niamey on August 6, 2023.

Niger coup leaders and di Nigeria intervention team wey include prominent Islamic scholars don 'agree' to pursue dialogue ova di political crisis for di kontri.

Dis dey come afta di intervention team meet wit di Nigerien coup leaders for di kontri capital Niamey ova di weekend.

For one statement on Sunday, August 13 by di Islamic leader Sheik Bala Lau, e say im and odas meet wit General Abdourahmane Tchiani for several hours and deliberate on all issues including di demand by Ecowas say make di coup leaders return former President Mohamed Bazoum to power.

Na President Bola Ahmed send di Islamic clerics to Niger afta im accept dia request to intervene.

Sheik Lau tok say before now dem don tell President Tinubu say di issue fit dey resolved wit dialogue.

Di Islamic cleric tok say im tell General Tchiani say di visit to Niger na to engage in constructive dialogue to encourage am and oda military leaders behind di coup to embrace peace instead of war to resolve di crisis.

E say General Tchiani give dem warm reception and welcome dia intervention.

“E tok say dia doors dey open to explore diplomacy and peace to resolve di mata.

“General Tchiani, however, tok say e dey painful to di coup leaders say di Ecowas leaders no hear dia side of di mata before dem issue ultimatum to dem to quit office,” Sheik Lau tok.

During di meeting, General Tchiani tok sorry say im no give di team led by General Abdulsalami Abubakar (retd) wey President Tinubu send di required attention sake of say im dey vex for di ultimatum wey Ecowas give dem.

“E trace di historical ties between di two nations and tok say Niger Republic and Nigeria no be only neighbours but brothers and sisters wey suppose resolve issues amicably,” General Tchiani tok.

Anoda member of di intervention team and Chief Missioner of Ansarudeen Society of Nigeria, Sheik Ahmad Abdulrahman, tok say contrary to some media reports, General Tchiani receive dem well and dem get fruitful discussion wit am.

"We believe say war no be beta wind and e no go blow any good and peaceful resolution gatz happun,” Sheik Abdulrahman tok.

Di team include scholars from various Islamic sects for di kontri.

Niger coup leaders and Nigeria intervention team 'agree to pursue dialogue'

Wia dis foto come from, @Ecowas_cedeao/Twitter

Wetin we call dis foto, Foto session by Ecowas afta one of dia meetings

Dis development dey come days afta leaders of Ecowas order di activation of Ecowas standby force for possible enforcement of dia resolutions for Niger days afta di seven-day ultimatum wey dem give di coup leaders expire.

Ecowas say dem go uphold all dia resolutions and add say all options remain open.

Di military intervention wey Ecowas get for mind for Niger dey cause tok-tok for different quarters wey believe say dis no be di right direction.

Niger dey share strong ethnic, economic and cultural relationship wit dia West African neighbors and some of dis relationship don spoil since di coup happun.

Nigeria don cut power supply to some parts of Niger, dem carry out one of di sanctions by Ecowas. Dis also don lead to travel bans and border closures.

Niger military pipo don do dia own too, dem call for di immediate withdrawal of dia ambassadors to Nigeria, France and US.

Residents for di border towns dey fear sake of di threat of military action and how e go affects Niger neighbors.

Di closing of land borders don begin dey affect economic activities for Niger surrounding communities, and di first pipo to feel am na traders and commercial transporters.