You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
'My love, father of my children pour me acid'
Blessing Chinedu na 25 year old acid survivor wey still dey wonder why her partner attack her wit di deadly chemical.
Na for June 2024 di incident happun for Udu area of Warri, Delta state for Southern Nigeria.
Blessing for interview wit BBC News Pidgin tok say evri tin happun very fast and bifor you know “my face don damage.”
“Na pesin wey I love, di papa of my children na im do me dis tin,” she tok.
Di young mama of two pikin say she dey reason many tins, “wetin happun dey really pain me but I no want make devil take over mind.”
Blessing say she no think say she fit forgive her man wey do am dis tin.
Tori be say Blessing attacker dey on di run since di incident happun for fear of say police go gbab am.
Di National Bureau of Statistics for dia data say di percentage of women wey dey between age 16 and 49 years wey don ever experience physical violence increase from 27.8 percent for 2013 to 31 percent in 2018.
Filmed and produced by Idara Monday