'I dey dye clothes to dash pipo for street'

'I dey dye clothes to dash pipo for street'

Habarata Daramani be young Ghanaian textile designer wey dey use dye to design clothes on di streets for Ghana.

She dey share dis shirts to hawkers and oda pipo for di street afta she design dem for lorry parks, markets and bus stations.

"When I reach di place, I go set up my table, my hanger and everitin I need. And pipo dey come around wey dem dey excited to see me do wetin I dey do for di street."

Di hawkers and oda vendors for di streets always dey stand by to watch her design di clothes.

Habarata say "some of di pipo even tell me dem want learn how we dey do am."

She get her own niche for di fashion industry for Ghana wey her unique handmade textiles dey trend dis days for weddings.

Di young lady wey learn di textile and tie-dye business from her mama, say at di beginning, e bin tough for pipo to accept.

She add say "at dat time e neva make sense to all of dem. But I fit tok say ova di years, di tin don pick up."

"Now everybody dey come to me for handmade textiles and fabrics."

Habarata don train over 500 pipo for di textile and batik business so say dem go get dia own job for dia hand.

She also dey open her textile studio for students to visit during excursions to learn about di textile and batik industry.

"As a young girl, dis dey make me happy. I neva sabi how much I dey inspire young girls until now."

Video by Komla Adom and Monday Idara.