Israel attack Damascus and warn of 'painful blows' against Syria

Foto of di impact of Israel attack on Damascus

Wia dis foto come from, Esref Musa /Anadolu via Getty Images

Read am in 4 mins

Israel don intensify dia airstrikes on Syria wit a latest attack on di capital Damascus.

Dem say dem dey intervene in support of di minority Druze community – wey dey currently fight wit oda Syrian armed groups.

Defence Minister Israel Katz share video of a live news broadcast wey show a direct hit on a Damascus building.

Israel say dem dey try to protect members of di Druze community wey dey for south-west Syria.

"We dey work to save our Druze brodas and to remove di gangs of di regime". Na wetin. Prime Minister Benjamin Nethanyahu tok.

Di srikes for Damasus dey come afta days wey Israel attack Suweida region for south-west Syria

Three Syrian commanders leaders die during di Israeli strikes on southern Syria, according to di Syrian Observatory for Human Rights (SOHR) monitor.

Di UK-based campaign group - wey dey monitor and release reports on casualties for Syria - say di strikes specifically target di military convoys as defence ministry officials bin gather.

Dem say di strikes bin come down for di countryside around di villages of Walgha and al-Majimar, near di city of Suweida wia clashes between armed Druze and Bedouin groups don dey take place in recent days.

Di SOHR previously bin report say na seven military officials die for di previous Israeli strikes in Suweida, including di ones wey dey on a tank and military vehicle - dis bring di total count to at least 10.

US Secretary of State Marco Rubio say "we dey very concerned" about tdi Israeli strikes on Syria.

Im tells reporters say di US want di fighting to end and confam say dem dey "tok to both sides", im add say hopefully dem fit stop am.

Rubio add say "hopefully" updates dey later.

Israel strike on Damascus on Wednesday dey come afta armed clashes between Sunni Bedouin fighters and Druze militias for southern Syria begin for weekend.

Di violence erupt predominantly for Druze city of Suweida on Sunday, two days afta dem gbab one Druze merchant while im dey travelling by road to Damascus.

On Tuesday, afta two days of di deadly clashes, Israel say dem bomb Syrian goment forces around Suweida.

Authorities accuse Syrian forces of also attacking di Druze. Di goment neva respond to den specific allegations, but dem condemn di attacks on Druze pipo and dem say dia troops dey dia to restore order.

Israel prime minister Benjamin Netanyahu say na im order di strikes on forces and weapons for di area becos di goment "intend to use [dem] against di Druze". Syria don condemn Israel involvement.

At least 200 pipo don die since di clashes start on Sunday, di UK-based monitoring group di Syrian Observatory for Human Rights tok on Tuesday.

Wetin to know about Druze?

Na around 100,000 Druze for Israel - dis picture, from October 2024, na one of di funeral of Colonel Ahsan Daksa, one Druze member for Israeli army, wey dem kill for Gaza

Wia dis foto come from, Getty Images

Di Druze faith na product of Shia Islam wit dia own unique identity and beliefs.

Historically dem occupy a precarious position for Syria political order. Half of dia roughly one million followers dey live for Syria, wia dem make up about 3% of di population, while dem get smaller communities for Lebanon, Israel and di occupied Golan Heights.

Earlier dis year, Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu bin warn say im no go "tolerate any threat to di Druze community for southern Syria" from di kontri new security forces.

Im also demand di complete demilitarisation of much of di south, im say Israel see Syrian president Ahmed al-Sharaa Sunni Islamist group, Hayat Tahrir al-Sham (HTS), as a threat.

Pictures wey don come out now dey show di extent of di damage to Syria defence ministry headquarters.

Dem stop traffic as security forces dey work for di area. Debris dey for roads and di front of di building dey partially destroyed.

Syria defence building

Wia dis foto come from, Abdulkarem Al-Mohammad/Anadolu via Getty Images

Debris dey for road from di blast

Wia dis foto come from, Abdulkarem Al-Mohammad/Anadolu via Getty Images