Key takeaways from Vice President Shettima visit to Mokwa as Tinubu approve N2bn to rebuild destroyed houses

Kashim Shettima

Wia dis foto come from, Kashim Shettima/Facebook

Read am in 3 mins

Nigeria President Bola Tinubu don approve di immediate release of ₦2 billion for di reconstruction of all houses wey flood destroy for Mokwa, Niger State, northcentral Nigeria.

Vice President Kashim Shettima announce dis informate wen e visit Mokwa Local Goment Area of Niger State for on di spot assessment, afta di serious flood wey destroy lives and property, and render hundreds of pipo homeless.

Oga Shettima add say President Tinubu don authorise di immediate release of 20 trucks of grains wey dem go deliver to victims.

Di floods, wey authorities describe as di worst for di area in 60 years, sweep through di Mokwa districts of Tiffin Maza and Anguwan Hausawa afta heavy rainfall.

Di official death toll afta di deadly floods hit di Nigerian town of Mokwa on Thursday, 29 May don rise to more dan 200, officials tok.

Anoda 500 still dey miss for di town, and local official Musa Kimboku tell BBC say rescue efforts don stop becos authorities no believe say dem still fit find anyone alive.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Key points from VP Kashim Shettima visit to Mokwa

During im vist, Vice President Shettima assess di extent of damage to infrastructure and agricultural lands for di town wey dey known as "di home of grains".

E say im visit na part of Nigeria goment immediate response to di flood disaster, following President Tinubu directive to provide swift assistance to affected residents.

Shettima assure di pipo of di state say di kontri leader heart dey wit di pipo and goment go address all di issues wey dey affect dem.

"Di president specifically order me to come to Mokwa to commiserate wit di pipo sake of wetin happun for di town. Im heart dey wit di grieving pipo of Mokwa.

"Di federal goment go address all di issues una raise in collaboration wit di Niger goment," e tok.

Bridges: Oga Shettima say President Tinubu don order make dem fix all di affected bridges immediately.

Drainages: On di issue of drainage, Oga Shettima add say di president don direct di immediate rehabilitation of drainages for Mokwa town.

"Di president don order say make di Ministers for Environment and State for Agriculture relocate to Niger to ensure immediate intervention under di ACRSAL project for drainage issues for Mokwa town."

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

Yakubu Garba, Niger State deputy govnor beg di federal goment for quick intervention to address di impact of di disaster.

"We need quick intervention as di four bridges wey collapse don cut down social and economic activities, especially for Rabba, as students no fit come Mokwa anytime rain fall," e tok.

Oga Garba say na ova 2,000 houses destroy and displaced victims dey manage wit pipo, e add say di state get available land wey dem fit use build houses for dem.

Earlier, di National Emergency Management Agency (Nema) report say di flooding wey happun for Mokwa fit lead to heightened risk of disease outbreaks sake of overcrowding and contaminated water sources.