Meet Adijat Adenike Olarinoye, she win Nigeria first gold medal for 2022 Commonwealth games

Adijat Adenike Olarinoye of Team Nigeria dey perform clean & jerk during Women Weightlifting 55kg Final on day two of di Birmingham 2022 Commonwealth Games

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Adijat Adenike Olarinoye of Team Nigeria perform clean & jerk during Women Weightlifting 55kg Final on day two of di Birmingham 2022 Commonwealth Games

Weightlifter Adijat Adenike Olarinoye don win Nigeria first gold medal for di 2022 Commonwealth Games wey dey take place for Birmingham.

Olarinoye lift a total of 203kg to win gold for di women 55kg weightlifting event.

She bin lift 92kg for di snatch, 111kg for clean and jerk, and lift 203kg in total.

India lifter, Bindyarani Devi Sorokhaniban settle for di silver, while England lifter, Fraer Morrow settle for di bronze.

Adijat Adenike Olarinoye

Olarinoye victory cause plenti jubilation for Team Nigeria camp afta di oda Nigerian lifters fail to make di podium.

Nigerians still dey hope say dia athletes wey go represent di kontri for di Commonwealth Games go win more medals afta Olarinoye victory.

Meet Adijat Adenike Olarinoye

Adijat Adenike Olarinoye of Team Nigeria take part for di medal ceremony for Women Weightlifting 55kg Final on day two of di Birmingham 2022 Commonwealth Games

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Adijat Adenike Olarinoye of Team Nigeria take part for di medal ceremony for Women Weightlifting 55kg Final on day two of di Birmingham 2022 Commonwealth Games

Adijat Adenike Olarinoye na 22 years old according to her informate for di Birmingham 2022 website.

Dem born Olarinoye on 14 July 1999.

She come from Southwest region of Nigeria.

Olarinoye don first help Nigeria win three medals for 2019 African Games wey dem bin do for Morocco.

Dat time, She get di first gold medal of di day for di 55kg category.

She den later add anoda gold for di 55kg Clean-jerk category before adding anoda silver medal.

Olarinoye also win gold medal for di 2021 International Weightlifting Federation, World Championship wey take place for Tashkent, Uzbekistan.