Nollywood actor Murphy Afolabi don die

Wia dis foto come from, @MurphyAfolabi
One Nollywood actor wey dey popular for Yoruba feem industry Murphy Afolabi don die at di age of 49.
Di Chairman of di Theatre Arts and Motion Pictures Practitioners Association of Nigeria (TAMPAN), Bolaji Amusan confam im death give BBC Yoruba.
Oga Amusan wey pipo sabi as Baba Latin say im just receive di news and neva sabi di cause of im death plus oda details.
Murphy Afolabi death dey come just about one week afta e celebrate im 49th birthday.
On im Instagram page on im birthday e pray and ask God for wisdom and knowledge to do im will and to live a righteous life.
E also add say; “Shout out to all wey no dey feel okay recently, but dey get up every day and no gree quit. Stay strong.”
Plenty of Yoruba actors don begin send condolence messages on dia social media handles to confam di death of Murphy Afolabi.
Popular Nigerian actor Odunlade Ademola, Saidi Balogun, Biola Adebayo, Tunde Ola Yususf among odas dey among dos wey express shock on im death and pray for di family.
End of Di one wey oda users dey read well well
Fans and colleagues don also send tributes to di late actor.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post, 1
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post, 2
Who be Murphy Afolabi

Wia dis foto come from, @MurphyAfolabi
Murphy Afolabi na popular actor, director producer. E dey popular for Yoruba feems and don feature for plenty movies wey include Okiki Oru, Blackout, Queen Lateefah, Four Lions, One Blood, among odas.
Dem born am on 9 May for Osogbo, di Osun state capital, South-West Nigeria.
For inside one interview wit BBC Yoruba, Murphy Afolabi say im no go grammar school but e study for di University of Lagos even though some pipo wey wan help am dat time gain admission to higher institution bin do am wayo.
E start im career for di late 1990s on stage and e dey popular for indigenous Yoruba-language movies.
Afolabi don produce several movies wey include “Enu,” “Gbolahan,” “Owo Ale,” “Asake,” and “Igbekun,” among odas.
E also don win awards for im contributions to di Nigerian film industry.
Oda celebs wey don die for 2023
Peace Anyiam-Osigwe
Di founder of di Africa Movie Academy Awards(AMAA), Peace Anyiam-Osigwe, die for January, 2023 at di age of 53.
Her family confam her death for inside one statement but dem no reveal di cause of her death.
Di late Ms Anyiam-Osigwe na Nigerian filmmaker and entertainment executive.
Reports say she direct di first music video of di hip-hop singing duo, P-Square.
Sunday Akinola
Sunday Akinola, talented Yoruba actor, wey dey popular for im role as Ayo Mogaji for ‘Feyikogbon’, di TV series, also pass away for January, 2023.
Sulaimon Aremu, one singer and poet wey pipo sabi as Ajobiewe, announce Akinola demise for one Instagram post.
Akinola death come come few months afta e mark im 80th birthday.
Im death also come few years afta e reportedly endure one long battle wit kidney failure.
‘Feyikogbon’, dey considered as Nigeria longest-running Yoruba language TV series, wey first air on NTA channels for di 1980s.
Femi Ogunrombi (Papa Ajasco)
Shaibu Husseini, one theatre practitioner and journalist, bin announce di death of Nollywood actor, Femi Ogunrombi wey pipo sabi as papa Ajasco inside one tweet.
Oga Ogunrombi bin dey popular for im role for Wale Adenuga Comedy series Papa Ajasco, di character e feature in wen Abiodun Ayoyinka comot di show.
Di medical practitioner bin decide to follow im passion for di arts for 1980.
For 1979, e bin shut down clinic to pursue im music career. E later go Obafemi Awolowo University to study Dramatic Art
Mr Ayoyinka played the role for eight years while the deceased took on the part for two years.













