Di four boys hide under bed as dia house burn and dem no fit escape di fire

Kyson and Bryson Hoath, aged four (left), and Leyton and Logan Hoath, aged three (right). All of dem dey smile for di camera, dem wear puffer jackets wit hats on.

Wia dis foto come from, Family handout

Wetin we call dis foto, Kyson and Bryson Hoath, four, and Leyton and Logan Hoath, three, all of dem die inside di fire
    • Author, Jeremy Britton
    • Role, BBC News
    • Reporting from, Old Bailey
    • Author, Olivia Demetriades
    • Role, BBC News, London
  • Read am in 4 mins

Court don sentence one woman to 10 years jail-term for di murder of her four sons.

Her children bin die inside house fire as she go out go do shopping.

30-year-old Deveca Rose, bin leave her two sets of twins alone for house wen fire burn dia house for Sutton, south-west London, on 16 December 2021.

Four-year-olds Kyson and Bryson Hoath and Leyton and Logan Hoath, wey be three-year-olds bin no fit escape, as di doors dey locked, dem die under one bed.

Dem find Rose guilty of four counts of manslaughter afta one trial for di Old Bailey last autumn.

Dem clear her of one single count of child cruelty.

Di family dey live inside di house and "rubbish full di floor plus pesin shit", di trial hear.

Police mugshot of Deveca Rose.

Wia dis foto come from, Metropolitan Police

Wetin we call dis foto, Deveca Rose leave her two sets of twins alone for dia house for Sutton wen di house catch fire

One fire investigation report conclude say di fire start either from one cigarette wey di fire no quench finish or from light wey dem no off, and e spread sake of di dirty wey dey di floor.

Judge Mark Lucraft KC wey sentence Rose tok say, nothing wey she go buy on di day di fire incident happun dey "essential or vital".

Dis na "very serious tragic" case wey involve di lives of four young children "wey die painful death within few moment from fire," Judge Lucraft tok.

E add say im don put into im decision say her eyesight dey very weak and now she no even fit see di boys inside pictures or videos.

"You go live wit di knowledge and bear responsibility for di deaths of your four children," Judge Lucraft add.

During di ruling, Rose siddon for di dock wit one anorak hood on top her head, she wear headphones - her defence barrister say na for medical reasons.

Di court hear statements from di family of di children wey describe how di tragedy take affect dem.

Wetin we call dis Video, Judge Lucraft said this was a "deeply tragic" case

For inside one statement dem read on behalf of di children father, Dalton Hoath, describe am as di "worst day of imlife" wen e lost im four "beautiful boys".

"Dia lives just start," e tok. "Na every parent nightmare - I dey devastated."

Di children great-grandmother Sally Johnson cry as she tell di court say: "Dem be my life. Now I feel so empty."

She say di only comfort at dis time of distress and sadness na say "all of dem now dey togeda forever and no need to ever dey alone again".

Ms Johnson bin finish her tok as she say she go like use di children favourite word "Why? Just why?".

Di boys' step-grandmother Kerrie Hoath tok say dia mother "use force collect di children from dem."

She say di boys na "beautiful, loving children" wey no deserve wetin happun to dem, and add say: "Di impact dem get on us for dia short lives no fit dey measured and we no go ever forget am.

"We miss dem every day and go always hold dem for our hearts.

Casey Hoath, step-grandmother Kerrie Hoath, and grandfather Jason Hoath, speaking outside the Old Bailey

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, (L-R) Casey Hoath, step-grandmother Kerrie Hoath, and grandfather Jason Hoath tok for outside di court afta di sentence hearing

'Ask for help'

One screengrab from Metropolitan Police CCTV show Deveca Rose for Sainsburys and she hold one big orange Sainsburys shopping bag.

Wia dis foto come from, Metropolitan Police

Wetin we call dis foto, CCTV footage show Deveca Rose at Sainsburys wen her four sons die for di house fire

During her trial Rose tok say one pesin wey im name na "Jade" bin dey wit di children wen she comot, Judge Lucraft tok.

"Di true position na say you leave your four boys aged four or under on dia own," e tok.

In mitigation, Laurie-Anne Power KC tok say Rose bin "ask for help and nobody show up for her".

She "love and cherish" her four children and she "look afta dem alone, as she struggle wit wetin experienced psychiatrists describe as complex psychiatric mental health needs".

Although Rose mental health bin get some influence on her actions, di judge say she bin still fall short of her responsibilities.

'Acts of heroism'

"Missed opportunities" bin dey to remove di children from dia home wen dia conditions begin worse, di defence pesin tok.

During di Covid pandemic, wit very little support, she bin visit her GP and say she no fit cope.

Judge Mark Lucraft KC tok say di firefighters wey visit di scene also dey affected by di deaths of di children.

Charlie Pugsley, London Fire Brigade deputy commissioner for fire safety, say: "Di incident dey very tragic we go continue to support all our firefighters wey dey there dat night.

"I wan pay special tribute to di incredible acts of heroism to those wey first arrive di scene, and go above and beyond to do all dem fit do to save di children."

"We go remember dis fire as an incredibly difficult incident wey get tremendous ongoing impact for everyone wey dey involved," e add.