Six ogbonge goals to remember about Nigeria striker Rashidi Yekini

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria number 1 football striker, Rashidi Yekini, for nack 60 years old today, if to say e dey alive.
Google celebrate di all-time leading goal scorer, wit one special doodle for im 60th posthumous birthday.
Today doodle celebrate Nigerian footballer Rashidi Yekini, wey dey remembered say e be di top goal scorer of di nation and widely considered one of di best Nigerian athletes of all time, google write.
Fans wey remember di 'legend' don enta social media, dey hail di Super Eagles star.
Nigeria first ever World Cup goal for USA 1994 still fresh for di mind of pipo wey watch am like say na somtin wey just happun. Dat goal come from di hand - or leg - of Super Eagles number '9' player inside match against Bulgaria.
Di year bifo, Yekini bin don already get African Footballer of di Year award, so pipo for im continent sabi am. But na di following year Yekini really introduce imsef to di world.
E play inside two major competitions - Africa Cup of Nations and FIFA World Cup - for 1994, di kain goals wey im score no be here.
Even though Yekini play for Europe, like many professional players, e later come back to Nigeria to play for Gateway FC at age 41.
End of Di one wey oda users dey read well well
'Goals to remember'
- E be di first ever scorer for Nigeria for di world cup (USA 94) against bulgaria
- Rashidi Yekini na di highest goal scorer for di Portuguese league 1993 1994 season, with 21 goals to win golden boot for Vitoria Setubal.
- Na Super Eagle highest goal scorer till date, wit 37 goals, dis na inside 62 appearances for di Super Eagles
- Nigeria all time leading scorer for di AFCON wit 13 goals
- Im goals make am di highest goal scorer for di Senegal 92 and Tunisia 94 tournament.
- E bin score career best 34 goals inside only 32 matches to help Vitoria setubal secure promotion into di primeira liga.
Tins wey you suppose sabi about Rashidi Yekini
Dem born am on 23 October 1963; im die on 4 May 2012 (48 years).
Yekini score 37 goals for Nigeria Super Eagles (58 appearances)
Portugal Primeira Liga top scorer (1993-94) with 21 goals.
Im foto for 1994 FIFA World Cup, wia im hold net dey cry afta im score, later go viral.
Im dey part of di team wey win di 1994 Africa Cup of Nations for Tunisia.
Im score 150 goals for im career,














