Liverpool win over Aston Villa revive hopes for dia Premier League campaign

Wia dis foto come from, Getty Images
Liverpool don revive dia hope for di Premier League afta a deserving 3-1 win over Aston Villa away.
Na Mo Salah open scoring for di Reds inside six mins while defender Virgil van Dijk double am for di 37th minute.
Aston Villa put up some threat for second half wit a solo goal by Ollie Watkins but e no dey enof to to save dem.
Substitute Stefan Bajcetic make am three for Liverpool for di 81st minute to seal am for di away team.
Second Half
Aston Villa 1-3 Liverpool
90+4mins: FULL TIME
90mins: Ben Doak produces low pass into di box
88mins: SUBSTITUTION. Ben Doak enta for Darwin Nunez.
End of Di one wey oda users dey read well well
86mins: SUBSTITUTION. Philippe Coutinho enta for Boubacar Kamara. Danny Ings enta for Emiliano Buendia, Leander Dendoncker enta for Bailey comes
Aston Villa 1-3 Liverpool
81mins: GOAL! Stefan Bajcetic wey just enta score for Liverpool
79mins: SUBSTITUTION. Stefan Bajcetic enta for Jordan Henderson. Joe Gomez enta for Trent Alexander-Arnold
78mins: Leon Bailey dey down injured
77mins: Fabinho makes a bad challenge and referee blow im whistle for a foul.
73mins: Ollie Watkins commit foul and Paul Tierney immediately signal a free kick.
71mins: Well-taken pass by Naby Keita. E unleash a strike from di edge of di box, e go over di bar.
70mins: Di opposition defence clear di resulting corner from Andrew Robertson
66mins: SUBSTITUTION. Naby Keita enta for Thiago. Harvey Elliott enta for Oxlade-Chamberlain.
64mins: John McGinn slide pass forward, but one of di defenders cut am out.
63mins: Villa clear cross into di box from Jordan Henderson
61mins: John McGinn shoot from outside di box, but dem block im effort.
Aston Villa 1-2 Liverpool
59mins: GOAL! Ollie Watkins score for Villa
56mins: Again Leon Bailey find some space to pass, but e no fit connect wit im team mate
55mins: Lucas Digne receive low pass inside di box, control di ball and release am towards di right post.
54mins: Leon Bailey send pass into di box, but dem clear am comot
53mins: What a great effort by Fabinho decide to unleash a long-range shot.
52mins: Poor attempt by Thiago
51mins: Mohamed Salah go on good run pass two defenders and pull di trigger in front of di keeper. Robin Olsen make a great save to stop di effort
51mins: A cross from a mid-range free kick by Aston Villa. Liverpool defender block am.
49mins: MISSED CHNCE! Emiliano Buendia pick up di ball in space and send shot from inside but e hit side net
46mins: DISALLOWED GOAL! Ollie Watkins bin score but ref rule am offside
Aston Villa 0-2 Liverpool
45mins: Second Half don start
First Half

Wia dis foto come from, Getty Images
Aston Villa 0-2 Liverpool
45+4mins: Half Time
45+3mins: Ref Paul Tierney stop di game afta foul by Mohamed Salah
45+2mins: Darwin Nunez dey vex for im sef as e waste better scoring opportunity!
45mins: Jordan Henderson collect a rebound and produce a mid-range attempt.
44mins: Andrew Robertson run towards goal but di defender get back well to make a challenge.
43mins: Aston Villa players dey exchange short passes wit dem sef.
40mins: Di percentage of ball possession na – 34:66.
Aston Villa 0-2 Liverpool
37mins: GOAL! Virgil van Dijk connect wit a pass inside di box and slam home into di bottom right corner.
37mins: Trent Alexander-Arnold take di corner for Liverpool.
34mins: OFFSIDE! Darwin Nunez no time im run well
31mins: Mohamed Salah hold on to a loft better pass and strike di ball!
29mins: Darwin Nunez react sharply to one cross from behind. Liverpool for just dey 2 goals up now but for day save.
26mins: Di ball spin up and hit di hand of Fabinho afta e fail to control am well. Ref blow foul.
21mins: Disallowed goal for Liverppol afta Matip score wit heading. VAR say NO GOAL
19mins: Paul Tierney blow whistle afta Douglas dangerous play.
16mins: Paul Tierney blow im whistle to caution Darwin Nunez for foul.
14mins: Leon Bailey come close to scoring but im last effort no make sense.
12mins: Liverpool hold possession of di ball and display neat passing from player to player.
9mins: Wasted opportunity by Leon Bailey.
8mins: Ref catch Ollie Watkins offside!
Aston Villa 0-1 Liverpool
6mins: GOAL! Fantastic team goal by Mohamed Salah
5mins: Tyrone Mings don kontinu to play.
3min: Di game dey on hold afta Tyrone Mings pick up knock.
2mins: Ollie Watkins get on di end of a cross inside di box and sweep di ball goalwards
1min: KICK OFF
Aston Villa vs Liverpool line ups
Aston Villa: Olsen, Young, Konsa, Mings, Digne, McGinn, Kamara, Douglas Luiz, Bailey, Buendía, Watkins.
Liverpool: Alisson, Alexander-Arnold, Matip, van Dijk, Robertson, Henderson, Fabinho, Thiago Alcántara, Salah, Núñez, Oxlade-Chamberlain
Aston Villa vs Liverpool team news
Di 2022 Fifa World Cup winner Emi Martinez no go dey available for di Aston Villa vs Liverpool match on Boxing Day.
But Robin Olsen suppose to don dey kampe as di deputy for goal.
Jacob Ramsey no go play sake of hamstring problem.
All Liverpool World Cup players fit dey available except Ibrahima Konate, wey go return to training on 27 December.
Trent Alexander-Arnold and Alex Oxlade-Chamberlain suppose comeback afta dia sickness but James Milner and Roberto Firmino go miss di next two games.
Aston Villa vs Liverpool head-to-head
- Aston Villa don lose eight of dia nine most recent league meetings, except di extraordinary 7-2 home victory for October 2020.
- Liverpool only oda loss for dia past 21 Premier League visits to Villa Park happun for May 2011 (W14, D5, L2).
- Di only previous Boxing Day league fixture between dis teams na Liverpool 2-1 away victory for 2001.
Aston Villa vs Liverpool match Stats
Aston Villa
- Villa win three of dia past four league matches, including two under Unai Emery. Na only two wins dem bin don get for dia final 15 attempts under Steven Gerrard (D5, L8).
- Dem fit get three back to back Premier League home wins in one season for di first time since a run of four from August to October 2007.
- Aston Villa don lose an unrivalled seven Boxing Day home games for di Premier League.
- Unai Emery only win in seven fixtures as manager against Jurgen Klopp in all competitions happun for Sevilla's 3-1 victory versus Liverpool for di 2016 Europa League final.
Liverpool
- Liverpool, wey dey sixth position, dey outside di top four on Christmas Day for di first time since 2015-16 wen Jurgen Klopp had been manager for only two months.
- Di Reds don drop 20 points for dia 4 league matches dis season. They only drop 22 points for di whole of 2021-22.
- Dem dey expect to win three top-flight fixtures back to back for di first time dis season.
- Liverpool don win five Boxing Day games back to back by an aggregate score of 15-0 since dia 2-1 defeat for Manchester City for 2013.
- Dem fit equal di top-flight record for most successive Boxing Day clean sheets: six by Manchester United from 1996 to 2001.
- Klopp fit equal Mauricio Pochettino Premier League record of five wins from as many Boxing Day fixtures as manager.
- Mohamed Salah don score for all of im past four starts against Aston Villa for all competitions.
- Joe Gomez na one short of 100 Premier League appearances.
- Andrew Robertson dey level wit Leighton Baines as di defender wit di most assists for Premier League history. Two of dem get 53.










