Kano community wey dey use shop and single bed as hospital wia patients dey see doctors

A shop with a single bed in Baita community of Gezawa local government area of Kano State, northwest Nigeria, that is being used as a hospital.
Wetin we call dis foto, One shop wit single bed for Baita community of Gezawa local goment area of Kano State, northwest Nigeria, wey dem dey use as hospital.
Read am in 6 mins

Di pipo of Baita, one village wey dey for Gezawa local goment for Kano State, northwest Nigeria dey call on di authorities to build healthcare facilities for dem.

For dis village, na one shop wey only one bed dey inside be dia hospital sake of say di healthcare facility wey dem get don spoil.

Na five doctors dey attend to patients for di shop wey dem turn to hospital, according to residents.

According to di villagers, dem build di abandoned healthcare facility for 1991, and goment no maintain am.

Di villagers tok say di clinic dey see more dan 10,000 patients evri month, and di pipo wey dey come na from about 10 villages wey dey around Baita.

Becos of how di clinic don bad, plus di cracks wey don full di walls, dem no fit use am again.

A shop with one bed that is being used as a hospital
Wetin we call dis foto, Shop wit one bed wey dem dey use as hospital
Healthcare facility building in Baita that has been abandoned for nine years.
Wetin we call dis foto, Healthcare facility building for Baita wey dem abandon for nine years

For di past nine years, dem dey move from one shop to anoda. Two years ago, dem manage get one shop wey get extra room.

Now, dem dey use one room for doctor to see patients, and di second room, wey get only one bed, na for patients wey dem wan admit.

Even wit dis arrangement, di villagers no happy becos di doctors no fit work well for di condition.

Di poor healthcare for di area don cause di death of many pipo, especially women wey dey born.

Some of di women die as dem dey try rush dem go big hospital for Minjibir or Gezawa.

One woman for di village, Zainab Abdullahi, tell BBC News Pidgin say she no dey happy anytime she carry her pikin go di shop wey dem dey use as hospital.

She even tok say she don lose two of her daughters during childbirth sake of say dem bleed afta dem born.

Healthcare facility building in Baita that has been abandoned for nine years.
A shop that is being used as hospital
Wetin we call dis foto, Shop wey dem dey use as hospital
A room where patients consult with doctors
Wetin we call dis foto, Room wia patients dey see doctors

"For more dan two years anytime I bring my pikins to di place e dey pain me to see say na shop we dey use as hospital, becos even di doctors no dey comfortable wit di shop becos e dey too small," Zainab tok

She add say "I lost my two daughters for labour. Di recent one wey happun few weeks back na afta she give birth she begin dey bleed none stop, she kon die on our way to take her to big hospital for Gezawa."

Zainab add say, "My oda daughter wey die long time a go also die wit similar problem of bleeding afta she give birth."

"If to say good healthcare facility dey for Baita, my two daughters go dey alive. So I dey call for goment make dem come repair our healthcare facility," she tok.

Also one family man for di village, Rabi'u Abdulmuminu, tok say im too lose im wife and pikin due to poor healthcare sector for Baita.

"Bifor me, many pipo lose dia dear relatives but e also reach my turn few months ago becos I lose my beloved wife and di baby."

Women in Baita bring their children for vaccine

Wia dis foto come from, Labaran Baita

Wetin we call dis foto, Women for Baita wey bring dia pikins for vaccine

Abdulmimunu add say "Di incident happun for night wen my wife dey about to give birth but she suffer a lot becos hospital no dey around for our village".

"Wen we reach di big hospital wey dey for Gezawa, she don already lose her energy, di baby kon die for her belle even bifor she born am," im tok

E add say, "She later kon die too, which I know say if to say we get proper hospital my wife and di baby still go dey alive."

Di head district of Baita village Alkasim Isiyaku tok say dem decide to comot from dia hospital afta dem see say di hospital walls fit collapse sake of say di walls begin dey crack.

Two people sit under a tree in Baita community of Gezawa local government area of Kano State.
Wetin we call dis foto, Foto of Baita community

Di district head say for many years dem don send letters to goment but neva get any response.

"We bin dey write to goment for almost seven years now to come and repair our clinical facility but dem no respond."

Di district head add say dem dey veri grateful for di woman wey decide give her shops as replacement of medical facility.

Hajiya Zuwaira Baita say she decide to give up her shops for free sake of women and children wey dey see doctors for di community and oda villages.

"I see say women and children no fit see doctors again if our health facility centre stop dey work."

A woman wearing hijab
Wetin we call dis foto, Hajiya Zuwaira wey give her shops for free

She say, "Many pregnant women and dia pikins from neighbourhood villages bin dey depend on single health facility wey dey for our village."

"So I decide to give my place temporarily bifor goment go come fix our hospital."

Di villagers dey call on goment intervention as women and children dey face challenges sake of lack of proper healthcare facility for di communities.

An abandoned facility
Wetin we call dis foto, One room for di abonded healthcare facility for Baita

Kano State Commissioner for Health Abubakar Labaran Yusuf tell BBC News Pidgin say im no dey aware of di situation for Baita sake of say im neva receive any official inquiry from dem. "I neva receive any official messages from dem but now dat I dey aware I go send pipo make dem go see wetin be dia situation," e tok.

"Den I go check if dem dey among di communities wey dey among di project we go commission, and if dem no dey among I go try put dem for di next phase wey go be early months of new year." Labaran add say for now dey get more dan 2,000 healthcare facilities for Kano.

As of now, 11 of dose healthcare facilities for villages for Kano don dey selected for renovation.

A man stands beside an abandoned healthcare facility in Baita community of Gezawa local government area of Kano State, northwest Nigeria.
Wetin we call dis foto, Foto of healthcare facility wey dem abandon