Di Duke of Sussex say im "go love reconciliation" wit di Royal Family inside exclusive interview wit BBC

Wetin we call dis Video,
Di Duke of Sussex say im "go love reconciliation" wit di Royal Family inside exclusive interview wit BBC

Di Duke of Sussex tell BBC say im "go love reconciliation" wit di Royal Family.

But e tok say di King "no go follow am tok bicos of dis security stuff".

For emotional interview, im tok say e bin dey "devastated" say im lose di legal challenge ova im security for UK.

You fit watch di full interview wey Prince Harry do wit Nada Tawfik for here.

For di interview, e say e no wan fight again and e "no know how much longer my papa get."

Prince Harry follow BBC News tok for California afta e lose appeal on top di level of security wey e and im family dey entitled to for di UK.

Buckingham Palace say, "all dis mata dem, court don check am well, and evritime dem don land di same conclusion evritime".

Afta Friday court ruling, di prince tok say, "I no see di world wey I go carry my wife and pikin dem go back UK at dis point."

"Plenti kasala don burst between me and some of my family" as e add say e don now "forgive" dem.

"I go like reconciliation wit my family. E no make sense to fight again, life dey precious", na so Prince Harry tok, as e say di kasala on top im security na "im always be di sticking point".

Prince Harry and Meghan Markle

Wia dis foto come from, Getty Images

Di prince bin wan reverse di change to im security wey dem make for 2020 afta im step down as working royal and move to di United States.

E tok say e bin feel "let down", e describe im court defeat say na "good old fashioned establshment stitch up", e come blame di Royal Household say na dem influence di decision to reduce im security.

Wen dem ask am weda e bin ask di King to chook mouth on top di mata of security. Prince Harry tok say, "I neva ask am to chook mouth - I ask am to comot from road make di sabi pipo do dia work".

Di prince say im treatment during di process of deciding im secuirty don "uncover my worst fears".

E say, "I dey devastated - not much because of di loss but for di pipo wey dey behind di decision, to tink dis dey okay. Na win for dem?"

E add say, "e sure me say some pipo out dia, most likely wey want bad tin to do me, wey see am as ogbonge win".

Prince Harry say di decision to comot im automatic security entitlement dey impact am "evri single day" and don leave am for situation wia di only way wey im go fit to enta di UK na if di Royal Family invite am as na only for dat kain time e go get enough security.

Di prince say di change for im security status for 2020 no only affect am but im wife and later on im pikin dem join.

E continue say, "evribodi bin know say dem dey put us at risk for 2020 and dem hope say bicos I sabi di risks, say e go force us up to come back.

"But den wen you see say dat one no work, you no wan keep us safe?

"Weda you be di goment, di Royal Household, weda you be my papa, my family, even wit all di differences, you no wan make sure say we dey ensure our safety?"

E tok say, "I love my kontri, I don always love am even wit wetin some pipo don do.. and I tink say e dey really sad say I no go fit show my pikin dem, my homeland".

Prince Harry say e no dey go back for any oda legal challenge, say, "Friday don prove say no way dey to win for courts".

E say di ruling bin surprise am say, "I wish pesin for don tell me dat bifor".

E continue say, "di koko na say na family fight be dis and I dey very very sad say we dey sit here five years later, wit decision wey most likely, in fact I know say, dis decision na to keep us under di roof."

Prince Harry for im BBC interview

Prince Harry follow di BBC tok-tok shortly afta im latest legal challenge against di UK goment on top di level of security im and im family fit get wen dem visit.

Di Court of Appeal dismiss di prince case wey dey based on how one official committee make di decision to remove im eligibility to automatic, full-scale protection, like di kain wey oda senior royals dey get.

On Friday, di court rule say Prince Harry bin make "powerful" arguments about di level of threat wey im and im family dey face but dem also say, im "sense of grievance" no "translate to legal argument".

Im legal complaint dey around one committee wey dem dey call di Protection of Royalty and Public Figures (Ravec) wey dey authorize security for senior royals for id Home Office and wey at di time, Sir Richard Mottram bin dey lead.

Prince Harry bin argue say under di committee regulations im case suppose go di Ravec Risk Management Board (RMB) wey go torchlight di threats to im and im family security but dat no happun.

On Friday, senior judges say di committee bin shift from policy wen dem make dia 2020 decision ova di prince security but conclude say e make sense to run am like dat bicos of di complexity of his circumstances.

Prince Harry say im "mouth drop for ground" wen e find out say representative of di Royal Household dey di Ravec committee and claim say Friday ruling prove say dia decision making process dey more influenced by di Royal Household dan by legal cnstraints.

E claim say di Royal Household chook mouth for di 2020 decision wey im tok say make im status as di most at risk royal to dey downgraded to di least at risk "overnight".

E add say, "so one go question how e even dey possible and wetin dey behind dat kain tin at di time."

Prince Harry don call on UK Prime Minister Sir Keir Starmer and Home Secretary Yvette Cooper to intervene for im security case and to overhaul how di Ravec committee dey work.

For statement wey im release later on Friday, di prince say e go write to Cooper to "ask am to urgently torchlight di mata and review di Ravec process".

Tok-tok pesin from di Home Office say di department dey "pleased" say di judgement bin dey di goment favour.

Dem add say, "di UK goment protective security system dey rigorous and proportionate.

"Na our long standing policy say we no dey give detailed information on dis arrangements as dat kain tin fit compromise dia integrity and affect pipo security".

Additional reporting by Sean Seddon