Watch how whale swallow one man briefly for southern Chile before e spit am out
- Author, Andrea Díaz
- Role, BBC News Mundo
- Author, Ayelén Oliva
- Role, BBC News Mundo
- Read am in 4 mins
One Venezuelan kayaker get experience of im life wen one humpback whale swallow am briefly as e bin dey paddle for di Strait of Magellan for southern Chile.
Adrián Simancas, 23 bin dey water togeda wit im papa, Dall Simancas, 49, wen di strange event happun.
Adrián remember for interview wit BBC say, "I feel like say sometin hit me from back and dey near me and sink me. Na so I close my eyes, by di time I open am again, I find out say I dey inside whale mouth."
Di papa and pikin just cross Eagle Bay wen Dall wey get camera for di back of im kayak to record rising waves, suddenly hear crash behind am.
Dall say, wen e look back, im pikin don disappear. E say, "Wen I turn back, I no see Adrián. I bin worry for a second until I see am dey comot from di sea. Den I see sometin wey resemble whale bicos of im size".

Adrián believe say e bin dey inside di whale for up to three seconds.
E describe di experience say, "I spend one second to realise say I dey inside di mouth of sometin, say e fit don chop me, say e fit be orca or sea monster".
"But den I start to feel like say I dey rise to di surface wen e spit me out. I go up for two seconds and finally I reach surface see say e no chop me and e no be predator."
Di two of dem wey move from Venezuela go Chile seven years ago to find beta life no believe say dem go get dat kain close brush wit nature for remote waters for di Chilean Patagonia.
Adrián say, "na experience wit wildlife for one of di extreme places for earth."
"I bin dey reason weda I go fit survive inside di whale. I bin wonder wetin I go fit do if e swallow me becos I no get how to fight and stop am again. By den, e don swallow me so I get to tink of wetin to do next.
"I bin dey fear weda I go fit seize my breath becos I no know how deep I dey and I bin reason say e go tay for me to come up."
Later wen Adrián see di video wey im papa record, e shock at how big di whale be.
"I bin no see wen di back appear and di fin dey sightable. I no see am, I hear am. I fear wella."

Wia dis foto come from, Dell Simancas
E add say, "but later wit di video, I see say e big sotay if I see am, na wetin for fear me pass".
For Adrián, di experience wey im describe as getting a "second chance" no dey about just survival na about reflection too.
"E make me tink wetin I fit do beta up to dis point and all di ways I fit take advantage of di experience and enjoy am well. Not only how to get di positive out of wetin dey negative but also to see di full picture wey be unique experience, na encounter wit wildlife for region wey dey for di edge of di world."

Wia dis foto come from, Dell Simancas
'Accident'
Roched Jacobson Seba, wey be Brazilian conservationist and president of Instituto Vida Livre, nonprofit wey dey advocate for wildlife conservation and research, say Adrián encounter "na accident".
E explain say, "di whale fit dey chop school of fish wen e mistakenly join di kayak wit im food."
"Wen whale surface too fast wen dem dey chop, dem fit accidently hit or chop wetin dey dia food road."
Oga Seba note say humpback whales get "narrow throats, like di size of household pipe, wey fit swallow small fish and shrimp. Dem no fit physically swallow large objects like kayaks, tires, or even big fish like tuna."
"Last last di whale spit out di kayak becos e bin no fit swallow am," e add.
He also warn say dis unexpected encounter na "an important reminder."
"Pipo no suppose dey go wia whale dey wit stand-up paddle boards, surfboards, or silent vessels," na so e warn, adding say boats wey dem dey use watch whale suppose keep dia engines on so di noise go make di whale know say dem dey dia.
"E dey important to respect dia natural habitat and make dem exist witout unnecessary human interference."
Additional reporting by Luis Barrucho










