Major winter storm wey hit di US kill at least seven pipo, 800,000 witout power

Wetin we call dis Video, Watch: Millions of pipo dey face power outage afta di winter storm scata many tins.
    • Author, Sakshi Venkatraman
    • Author, Elizabeth Rizzini
    • Role, Lead Weather Presenter
    • Author, Toby Mann
  • Read am in 5 mins

One dangerous winter storm don scata many places for di US, wey kill at least seven pipo; wey e don cut power to thousands of homes.

Dem close schools and roads across di kontri wey flights dey cancelled as "life-threatening" conditions dey stretch from Texas to New England, according to di National Weather Service (NWS).

At least two pipo die from hypothermia (dem lose heat wey dia body temperature drop) for Louisiana.

Oda deaths dey linked to di storm wey dem report for Texas, Tennessee and Kansas.

By Sunday, more dan 800,000 households no get power, according to poweroutage.us. Meanwhile more dan 11,000 flights dey cancelled, FlightAware bin report.

Plenti heavy snow and di freezing rain fit last for days wey di storm fit affect around 180 million American pipo - more dan half of di population.

"Di snow and ice go dey veri slow to melt, e neva fit go away soon, dat fit affect di recovery effort," Allison Santorelli, meteorologist wit di National Weather Service, tell di BBC US media partner CBS News.

Louisiana Department of Health don confam say two men die from hypothermia on Sunday.

Di mayor for Austin, Texas, say one "exposure-related" death don happun.

Officials for Kansas also tok say dem find di body of one woman wey snow don cover all her body - e fit be say "she bin die from hypothermia."

Dem also report di death of three oda pipo for Tennessee.

New York City Mayor Zohran Mamdani don write on top im X handle say at least five pipo for di city don die on Saturday but im add say dem no find di cause of dia death yet.

A man rugged up in heavy winter clothing uses a tool to clear snow packed into a shovel he is using to clear part of a road near a line of parked cars, all of which have snow over their roofs and windscreens.

Wia dis foto come from, Will Oliver/EPA/Shutterstock

Wetin we call dis foto, Washington DC dey experience one of dia biggest snowstorms for di last 10 years

New York state Govnor Kathy Hochul don warn residents say make dem dey indoors wey dem for stay away from roads.

"Dis na di coldest weather we don see, di coldest winter storm we bin see in many years," she tok on Sunday.

Hochul say di "brutal" conditions dey expected to bring di longest cold stretch and highest snow falls in years.

"E dey chill di bone - dis be dangerous," she tok.

Kentucky Govnor Andy Beshear tok for Sunday say di kontri dey see more ice and less snow dan wetin dem first predict.

"Dis neva be good news for Kentucky."

Sabi pipo don warn say one ogbonge dangers of storm na ice, wey e fit destroy trees, affect power connection wey e fit make di roads unsafe.

For Virginia and Kentucky, authorities don respond to hundreds of crashes on top di roads.

Canadians don also suffer heavy snow wey dem cancel hundreds of flights.

Officials dey estimate say di snow fit continue to fall (15-30cm) for di province of Ontario.

Wetin we call dis Video, Di winter storm dey continue to sweep east across US

Dem declare emergencies for some states

About half of di states don declare emergencies wey schools across di kontri bin dey cancel classes sake of di storm dey continue into Monday.

Di US Senate also scata dia schedule voting wey dem plan for Monday evening.

Washington Mayor Muriel Bowser tok as im declare emergency for di capital say "we dey experience di biggest snowstorm in 10 years for DC dis weekend".

While places for di north like Dakota and Minnesota dey used to temperature below freezing level for di winter, e dey unusual to see dis kain extreme cold for states like Texas, Louisiana and Tennessee, wia di temperature dey around 15-20C below di seasonal average.

Two people, dressed in thick coats, walk through the snow in New York City

Wia dis foto come from, Getty Images

Di polar vortex - wey be one strong westerly wind wey dey form from above di Arctic evri winter wey dey contain pool of cold air - dis bin lead to di powerful storm, according to sabi pipo.

For dis case, di winter storm dey push to di north and east, wey e dey clear di Canadian maritime by Tuesday - wey e dey leave more cold air behind.

Dem forecast say e go dey cold like dis (dangerous) until di beginning of February.

Some sabi pipo believe say climate change fit influence di behaviour of di polar vortex sake of changes for di sea surface temperature for di world.