‘I feel better as I dey break tins to ease my frustration’

‘I feel better as I dey break tins to ease my frustration’

Nigerians dey face different daily frustrations and stress wey dey cause anger wey many pipo dey endure and dem no get safe space to vent dia emotions.

For Lagos, pipo dey waka wit anger and frustration wey dey rise everyday sake of wetin dem dey face on a daily basis for di city wit ova 12 million pipo.

Many of diz anger and frustrations dey traced to economic hardship, constant traffic congestion and human activities.

Some pipo dey feel like to dey throw objects or smash dia home appliances sake of say dey wan let out dia anger.

BBC Pidgin bin follow di lives of Lagosians wey dey find how dem go vent dia pent-up anger and frustrations.

Shadow Rage Room na di space wia Lagosians fit visit to go break different items wey include televisions, keyboards, bottles and many oda home appliances.

According to di founder of di rage room Banjoko Babajide James, e say e dey clear say many Lagosians bin need a space wia dem fit let out dia anger sake of wetin dem dey face for di kontri.

Di World Economic Forum don already tok say an estimation of ‘100 million pipo for Africa dey suffer from clinical depression, including 66 million women’.

Wit dis number, e show say a lot of pipo dey battle wit depression, bottled-in frustrations and anger wia dem dey search for how best dem fit vent dia anger.

Produced by: Adesola Ikulajolu

Video by: Olawale Adekola