Anthony Joshua use knockout win to set up ogbonge fight wit Wilder

Anthony Joshua secure im first knockout since 2020
Wetin we call dis foto, Anthony Joshua secure im first knockout since 2020

Heavyweight Anthony Joshua knock out Robert Helenius wit one punch in round seven, afta e use caution dey box in di first half of di fight for London's O2 Arena.

Di 33-year-old Briton – wey fans been dey boo during di fight – no land better punch until e use im overhand right end Helenius night.

Di win - Joshua first stoppage win in two and half years - set up a blockbuster fight wit American Deontay Wilder in January.

"Na sport wey dey change, you gatz dey real to about dis industry and no get caught up. I don do my job tonight," Joshua tell BBC Radio 5 live.

Wen dem ask am about di potential fight wit Wilder, Joshua joke: "My back done go, doctor dey here? I wan carry dis heavyweight division to di top."

Afta di knockout, di emotionally charged and smiling Joshua climb out of di ring, give fans high-five and share beer wit Irish mixed martial arts star Conor McGregor.

Dem gatz give Helenius oxygen afta di heavy knockdown, but e recover and leave di ring wit out assistance afta congratulating Joshua.

Joshua extend im record to 26 wins - wit 23 stoppages - and three defeats.

Findland boxer, Helenius wey take dis fight on one week notice afta Britsh boxer Dillian White bin fail drug test, don lose im fifth pro fight ot of 36 outings.

From cautions start to classic 'AJ' finish

E bin dey hard for Joshua to find im rhythm but di way im finish come take win give am di ginger im really need and show oda heavyweights say e still dey o!

Becos Whyte bin no fit fight for dat match, dem bin offer fans full refund, but di kain ogbonge vibes wey Joushua get make am so dat empty blue seats bin no dey at all for di arena wen di main match start.

E bin enta di ring to combination of a violinist wey dey play di sountrack from di feem "The Godfather" and "Insomnia" by Faithless.

Dis na di ninth time wey di 2012 Olympic gold medallist go fight for di O2 Arena.

E bin look firmly for Helenius during introductions wey bin dey mockingly clapping about am.

In di first few seconds, Helenius enta di middle of di ring and swing wild left. For di opener of di game, none of di men really land beta hit on each oda.

Di way dem bin dey fight make fans start to vex for di thrid round - dem even start to dey boo join di mata.

Joshua neva knock out opponent for di first half since 2016 beating wey im sama Eric Molina, and dat na ogbonge statistic for pesin wey dey seen as one of di heaviest hitters for boxing.

Anthony Joshua bin sama Helenius wit ogbonge left for di fourth wey move Helenius go back howeva e no folow am wit consistent beating.

E come ginger Helenius swagger and e land jabs wey mark Joshua under im eye for di fifth. By di time di match reach di middle, di crowd bin dey bored and kontinu to boo.

Joshua bin tell im trainer Derrick James say , "e dey hard to find di right hand", James tell am to "keep trying".

Na how e follow di instructions cause am to give wetin promoter Eddie Hearn call di "knockout of di year", wey pipo wey vex comot di arena bin miss.

Double feint followed by one right na im land Finn for ground as referee Victor Loughlin stop di match.

'We hope Wilder fight go soon come' - Hearn

Anthony Joshua

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Joshua dey toks to fight Wilder for January

Representatives form Saudi Arabia bin attend di match, as dem ready to finish negotiations for Joshua-Wilder mega fight to hold for di Middle East early next year.

All Joshua bin need do na to make sure say Helenius no beat am or as boxing pipo dey call am turn im banana skin. But lucky for am and Wilder dat open no happun.

Hearn say, "we hope say e go dey soon. Na why we bin want di Dillian Whyte fight. E don hard for am to get fights like dis.

"If e hit Wilder for chin, e don finish. Dis about Anthony Joshua now, no be about pleasing odas. E don pour evertin inside dis British boxing."

Dem don dey hype dis Joshua-Wilder fight since di two heavyweights togeda bin get all di four world titles.

Boxing politics bin no allow am happun but di money wey dey ground for Middle East showdown fit cause more anger wey both players or dia promoters no go just wan let go like dat.

Di winner go go back to contend for world title again and di pesin wey lose fit use di career top money e go receive take clean im tears.

Wilder wey dey come from Alabama na of one of di toughest punchers for heavyweight history. Di man wey dem dey call Bronze Bomber bin KO Helenius within three minutes for October and fans bin expect Joshua to achieve di same kain tin.

But even wit di ogbonge way dis match end, questions still dey about how Joshua perform.

Di cautious approach wey im use for di beginning of im match fi no make sense with Wilder.

Former world champion David Haye tok for BBC 5 live say, "I just wan see AJ fight pesin wey dey di same level as Robert Helenius and treat am like say e be Wilder. E no fit just stand dia dey jab, e no go work for Wilder. E go just run enta am."