Over 115 pipo die for wedding fire for Iraq

Wia dis foto come from, Social media
More dan 100 pipo don die wit 150 injured for one fire wey happun for one wedding party for Hamdaniya district for Iraq Nineveh province.
Hundreds of pipo bin dey celebrate for Qaraqosh for Iraq northern Nineveh province wen fire tear through di venue late on Tuesday evening.
E neva clear wetin cause di fire, but early reports tok say di fire start afta dem lit fireworks.
Di deputy govnor of Nineveh, Hassan al-Allaq, tell Reuters say 113 pipo dey confirmed dead, while state news agency INA put di death toll for at least 100, and 150 pipo injure.
But he suggest say di number of deaths and injuries no dey fixed and e fit increase.
Di civil defence dey search for di deadi body of pipo wey don burn and survivors for di building wey burn to pieces.
Di fire tear enta one big event hall for north-eastern region afta dem light fireworks during di celebration, local civil defence tok.

Wia dis foto come from, Getty Images
Flammable panels for di venue fit don fuel di flames, wey make parts of di ceiling to catch fire and fall.
End of Di one wey oda users dey read well well
"Di fire make some parts of di hall collapse sake of di highly flammable materials dem use, low-cost building materials fit collapse within minutes wen fire break out," Iraq civil defence directorate wey di state news agency INA quote, tok.
One foto wey Nina post show as dozens of firefighters dey try quench di fire, and pictures from local journalists on social media show wetin burnt-out remains of inside di event hall.
E show as firefighters dey climb ova di wreckage of di building to find survivors on Wednesday morning.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di couple dey dance wen di fire start - Eyewitness tok

Wia dis foto come from, Getty Images
Eyewitnesses tok say hundreds of pipo bin dey celebrate wen di building catch fire at around 10:45 local time (19:45 GMT) on Tuesday.
"We saw these as huge fire dey come out of di hall. Those wey fit manage to come out, escape but those wey no fit escape, dey stuck. Even those wey escape na wit serious injuries," Imad Yohana, one 34-year-old who wey escape di fire, tell Reuters.
Anoda wedding guest, Rania Waad, wey her hand burn tok say na as di bride and groom dey do slow dancing "fireworks start to climb to di ceiling, di whole hall catch fire".
"We no fit see anything," di 17-year-old tell news agency AFP. "We bin dey suffocate, we know sabi how to get out."
Anoda survivor tok say several members of im family dey among di victims.
"Wen di fire start my mother bin dey bathroom," e tok.
"I no see her. I look for my daughter, my son, my wife, my father and I no see dem. A don go."

Wia dis foto come from, Getty Images
For di main hospital for Qaraqosh, wey dey for east of di region capital Mosul, dozens of pipo don land for there to donate blood to help those wey injure. Di town of Qaraqosh also dey known as al-Hamdaniya and Bakhdida for Iraq.
Iraq prime minister post on X, formerly known as Twitter, say im don tell im officials to "mobilise all efforts to provide relief to those wey dey affected by di unfortunate incident".
Burns and asphyxiation or lack of oxygen na im lead to di death of more dan 100 pipo for di wedding hall, Iraq health ministry tok-tok pesin tok, Saif Al-Badr.
Al-Badr tok say di fire also cause di crowd crushes.
Health officials say majority of pipo wey wunjure and di victims na young men and women.
Di prime minister of Iraq don order investigation into di fire and ask officials to provide relief to those wey dey affected.
One Iraqi journalist for di city of Erbil, wia dem dey treat some victims tell BBC say enough "logistical tools no dey to rescue di pipo" plus Mosul no get enough ambulances, staff and medical equipment.
"Local officials of Mosul dey blame Iraqi government say dem no solve hospital problem, and generally, di problem wey dey di health sector for Mosul afta ISIS (Islamic State group) occupy di city," Blesa Shaways add.
Mosul gain independence from three years of IS rule for 2017 afta one brutal fight wey leave di city for ruins.

Wia dis foto come from, Reuters
Some media reports tok say di couple hold Christian wedding, though dis neva dey confirmed.
Qaraqosh na di biggest Christian town for Iraq before IS take over am for 2014 and most run sake of persecution.
IS militants commit many atrocities against di Christians wey remain before di Iraqi and US-led coalition forces drive dem comot for 2016, dem reportedly burn to di ground more dan 2,000 houses.
Dem tok say about half of Qaraqosh residents don return since dem free di town but dem neva rebuild many of di houses dem destroy.
Such incidents dey common for Iraq - where corruption and mismanagement na normal thing and dem also lack accountability.
For 2021, officials tok say lack of safety measures bin don contribute to di deaths of nearly 100 pipo for one fire for one hospital for di city of Nasiriya.














