Funke Akindele confam say she be PDP deputy govnorship candidate for 2023

Funke Akindele confam to be di Lagos PDP fdeputy govnorship candidate

Wia dis foto come from, FUNKE AKINDELE

Wetin we call dis foto, Funke Akindele confam to be di Lagos PDP fdeputy govnorship candidate

Popular Nollywood actor, Funke Akindele don confam say she be di deputy govnorship candidate for di Peoples Democratic Party, PDP for Lagos State for di 2023 general elections.

Funke wey announce am for inside video on top her official Instagram handle say she go be di running mate to Abdulazeez Olajide Adediran, di PDP govnorship candidate.

She say she dey run to help assist and contribute to di growth of youth, women and children as she don see as dem dey suffer.

“Wen Dr Abdulazeez Olajide Adediran JANDOR, ask say make I be im running mate as deputy govnor in next year’ general election, I see am as opportunity to liberate and improve di welfare of our pipo, particularly di deprived youth, women and di girl child.”

"My decision no be just to accept dis big responsibility but to also work tirelessly and complement Jandor burning desire to see our dear Lagos live up to im full potential wit di pipo as immediate and direct beneficiaries”

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Funke Akindele say she dey put her career on hold because di work she wan embark on require huge personal sacrifice.

Di Lagos PDP deputy govnorship candidate also call on di youths for di state to take advantage of dia number to make changes for di 2023 election.

Her announcement dey come few weeks afta anoda Nollywood actress Tonto Dike emerge as di deputy govnorship candidate of di African Democratic Congress (ADC) for di 2023 general elections for Rivers state.

Lagos state govnorship candidates

Lagos govnorship candidates for 2023 general elections

Wia dis foto come from, Facebook

Wetin we call dis foto, Lagos govnorship candidates for 2023 general elections

Ahead of di 2023 general elections, political parties don arrange pipo wey go lead di biggest commercial city for Nigeria, Lagos state.

Di ruling party, All Progressives Congress (APC) say make Babajide Sanwo-Olu wey be di sitting govnor continue for di position to finish im second term.

Abdulazeez Olajide Adediran emerge as di govnorship candidate of di Peoples Democratic Party (PDP).

Hakeem Dickson na di govnorship candidate of Accord party while James Adeshina na di govnorship candidate for African Action Congress party.

Who be Funke Akindele?

Nigerian actor Funke Akindele

Wia dis foto come from, Funke Akindele

Wetin we call dis foto, Funke Akindele na Nigerian actor

Dem born Funke Akindele on 24th of August, 1977 inside Ikorodu, Lagos State.

Her papa na school principal and her mama na medical doctor.

She attend Grace Children Schools, Gbagada and Lagos State Model College, Igbo-kuta.

Funke get OND in Mass Communication from Moshood Abiola Polytechnic, Ogun State and a Law degree from the University of Lagos.

Funke Akindele be Nigerian actress, film producer, scriptwriter, and entrepreneur. She dey popularly known as 'Jenifa', one character she play inside one of her movie series titled Jenifa.

Funke Akindele get a special swag for Nigeria entertainment industry. Na sake of how she dey interpret her roles even for her own soap opera 'Jenifa's Dairy'.

Funke bin marry Adeola Kehinde Oloyede on May 26, 2012 and dem divorce in July 2013 citing irreconcilable differences. She marry Abdul Resheed Bello, known as JJC Skillz for May, 2016.

Recently, JJC Skillz announce say dem no dey togeda again.

Funke and JJC Skillz get two children togeda.