‘Davido, Logos Olori no owe anybody apology’ – Soyinka react to Jaye Lo video controversy

Davido and Logos Olori

Wia dis foto come from, Getty Images/ Instagram/@logosolori

Nigerian Nobel-Prize winning writer, Wole Soyinka don defend Afrobeat star Davido ova one controversial music video wey offend some Muslims.

Davido bin share one video wey one singer wey dey signed to im label singer. Di video reportedly show men wey dey dance outside one mosque.

Dis cause kasala for some Muslim circles, as some of dem begin down Davido posters, local media report.

Davido don since delete di video but 89-year-old Soyinka tell am say make e no apologise.

"I neva see di clip, but I insist on di right of di artiste to use dance for religious setting as a fundamental given.

“No apology dey required, none should be offered. Make we stop to dey bow to wetin some pipo believe,” Soyinka tok for im letter to Premium Times on dis matter.

Several high-profile figures don condemn di video, including former lawmaker Shehu Sani, wey tweet say make Davido apologise because fans dey "offended" by di video.

Bashir Ahmad, adviser to ex-President Muhammadu Buhari, write to im 1.6 million followers say di content bin dey "absolutely disrespectful hurtful and offensive".

"We Muslims no dey mix our religion wit jokes in any way," e write, especially anything wey gatz do wit prayers.

Logos Olori video spark reaction for social media wey make pipo dey do Davido poster anyhow.

Dis na over gbas gbos of video wey di artiste bin use promote one new song wey a member of im record label, Logos Olori release.

Di song name na 'Jaye Lo'.

Di video bin comot ova di weekend and don create ogbonge buzz on social media.

Mata start wen Davido and di artiste Logos Olori comot wit visuals for di song.

Di less dan one minute trailer clip bin start wit camera wey first show Logos Olori dey jam to im song as e dey siddon for roof near loud speaker.

Den di camera come move to reveal pipo wey look like dem dey pray for di Muslim way complete wit dia prayer mat as dem all wear white from dia jalabbiya to di cap wey dey dia head.

Di men in all white wey bin just dey like dem dey pray soon afta start to dey dance to di song.

Dis come dey followed shortly wit wetin look like di guys start to dey dance in sync with demselves.

Di song lyrics also feature some Islamic words for inside:

"Alhamdulilah say big money coming

Maliaka mi ni OBO noni"

All in all, na dancehall music on how money don come now.

But Muslims no really Jaye like di song bin advise based on di Muslims wey dem bin show for di video trailer.

How pipo react to di video

Many pipo call out di video say e dey disrespectful to di Islam religion.

Dis include some popular pipo like Kannywood actor, Ali Nuhu and former Presidential aide for Digital Communications, Bashir Ahmed.

Ali Nuhu bin explain say e dey okay to dey creative but e bin hala say di video dey completely unacceptable for Islam.

E later take down di post afta di video comot from Davido page as well as call of di cancelation of di Timeless star.

Bashir Ahmed also call di video disrespectful as im add say e dey offensive and hurtful. E say Muslims no dey mix dia religions with jokes in anyway.

Ali Nuhu post

Wia dis foto come from, Intagra/@realalinuhu

Bashir Ahmad post

Wia dis foto come from, Twitter/@BashirAhmaad

Howeva for di oda side of tins pipo dey stand up for Davido side on top di video and how im bin choose to address di mata.

Dem argue on top di different videos wey dey online wey show obvious Muslims dey dance to music.

Dem also release videos wey Arabs dey dance to regular music.

How Davido react to di gbas-gbos

Davido wey finish di North America leg of im Timeless tour earlier dis month neva tok anytin ova di gbas-gbos online.

Howeva im and im artiste Logos Olori don comot di video from di social media.

Dis one cool actor Ali Nuhu mind as im delete im cancellation post on Davido but some pipo still dey burn im posters for inside video till im comot apologize for di video.

As at di time of dis report dat one neva happun

Who be Logos Olori

Davido and Logos Olori

Wia dis foto come from, Twitter/@logosolori

Wetin we call dis foto, Davido and Logos Oloi for dia Lagos performance in April

For March, wen Davido bin dey announce im Timeless album na wen im introduce Logos Olori as new sign-in for im DMW record label.

Logos Olori wey im real name na Olalekan Emeka Taiwo na singer and song writer wey don dey for street since like 2020.

Cos na for dat 2020, e bin drop di song, Shine and Logos Party wia im bin feature anoda artiste Dan-Dizzy.

Jaye Lo go be di fist single wey di PPicasso featured artiste don drop as e don dey for di Lagos and Dubai leg of di Timeless tour with Davido.