Arsenal maintain lead despite Brentford draw

Getty

Wia dis foto come from, Getty Images

Substitute Leandro Trossard score im first goal for Arsenal but di Premier League leaders miss di chance to stay ontop of di league wit eight points clear, as Ivan Toney give hard-fighting Brentford one point wey dem hustle for.

After di two teams no score goals for first half, wey di Bees hit bar thru Toney, di Gunners take di lead wen Trossard strike for back of di post four minutes after im enta di match from bench.

But Brentford get di reward wey dia excellent away performance for di Emirates Stadium deserve wen Toney nod Christian Norgaard cross from close range.

Di video assistant referee take time check di goal well well for possible offside for di build-up but dem confam di goal last last.

Arsenal increase di tempo wen si match wan end -including seven minutes added time- as dem bin dey try to win but Brentford complete an excellent defensive display as dem hold dia one point kakaraka.

Arsenal go face Manchester City-six point ma behind before dia game on Sunday afternoon against Aston Villa, na top of di table kwanta between leaders and runners up on 15 February.

Meanwhile Brentford dey eighth and five points from fifth position

SECOND HALF

90 mins' + 9 FULL-TIME

Arsenal 1-1 Brentford

90 + 8 Schade replace Toney as e be like say e don injure

90 mins' + 6 Norgaard chop yellow card after a poor challenge on Zinchenko.

90 mins' + 2 Brentford dey run di clock down at every opportunity dem get as dem look to comot di Emirates with at least one point.

88 mins' Zinchenko take another shot for Arsenal but e no find di goal.

80 mins' Brentford dey sit deep for di half but trying to press Arsenal wen dem fit.

74 mins' GOALLL!!!

Toney gets on di scoresheet to equalise for Brentford! Di visitors win three consecutive headers for di box before Norgaard cut di ball back for Toney to head into an open net!

70 mins' Trossard dey isolated as Arsenal counter forward so e try shoot from a difficult position. E shoot with power but e fail to test Raya.

66 mins' GOALLL!!!

TROSSARD net di ball!!

Arsenal dey finally find di breakthrough as Trossard score im first goal for di club! Saka and Odegaard play one-two before di winger put in a low cross along di six-yard box.

56 mins' CHANCE!

Arsenal fail to clear di lines and Brentford break into di box. Jensen lay di ball off for Toney, and di striker effort no work.

51 mins' SAVE!

Nketiah do well to dribble past Ajer and get a cross to Odegaard for di box. Di midfielder shoot with im weaker right foot and di ball go straight at Raya, wey make a good stop.

48 mins' Di second half dey start like how dem play di first half. Arsenal dey attack down di wide areas while Brentford look to play very direct.

46 mins' KICK-OFF

Nketiah get di second half underway for Arsenal!

FIRST HALF

41 mins' Martinelli air di ball to di far post for White to attack, but Brentford defenders cut di pass wey im shoot toward Saka out.

39 mins' SAVE!

Toney shoot from close to 30 yards out to try and catch Ramsdale off guard, but di goalkeeper react quickly and jumps to make di save.

35 mins Arsenal still dey try use dia passing combinations to try and breakdown di low block of Brentford, but di away side dey cope well.

33 mins' Play continue as Martinelli bounce back

31 mins' Direferee stop play as Martinelli require treatment for head injury.

29 mins' Raya show incredible composure to turn away from Nketiah and pick out Toney with one long ball. Brentford win di knockdown and attack in numbers but fail to produce a shot at goal.

15 mins' CHANCE!

Saka play one ogbonge give-and-go with Odegaard before bearing down on goal.

E only poke di ball at Raya as e stumble to di ground while shooting.

7 mins' Brentford dey look to play very direct for dis match. Dem dey launching long passes for search of di likes of Toney.

5 mins' HUGE CHANCE!

Brentford break forward down di right wing, with Toney on di ball. E cross di ball along di six-yard box and Henry get to am ahead of everyone else. E fails to direct di ball on target despite di close range.

4 mins' Xhaka commit di first foul of di game after being too physical with Ajer as dem both try to win di header from Nketiah cross. Di midfielder no det too happy with di referee decision.

3 mins' Arsenal no dey show no signs of a hangover from dia loss to Everton as dem play out from di back with confidence against a good Brentford press.

1 min' KICK-OFF

Brentford get di first half underway for di Emirates Stadium!

Head to Head

Di only win wey Brentford don get for eight league and cup games away to Arsenal na 2-0 for di top flight at Highbury for April 1938 (D3 L4).

Mikel Arteta side dey try to complete a league double over di Bees, wey go become di 47th club wey Arsenal don beat home and away inside one single Premier League campaign.

Match Stats

Arsenal

Arsenal defeat wen Everton beat dem, na di first time Arsenal dey lose in 14 league games, even though dem dey unbeaten for dia nine top-flight home fixtures dis season, dem win eight.

Arsenal dey risk to lose three successive matches for all competitions for di first time since April 2022.

Di north London club dey aiming to win dia eighth consecutive Premier League London derby, wey fit equal di record for a single season (wey Chelse set for di 2005-06 and 2014-15, and Arsenal in 2013-14) seasons.

Dem don score 16 goals and concede just three for dia previous seven top-flight games against fellow London clubs.

Di last two Premier League goals wey Arsenal concede come from corners - just one of di first 15 dem ship dis season was scored like dat.

Brentford

Brentford dey unbeaten for nine Premier League matches (W5, D4) - only Newcastle, naim neva lose inside 16 games, dem dey cari shoulder sake of dia beta current form.

Di Bees dey try to keep four consecutive top-flight clean sheets for di first time for dia history.

Dem don keep back-to-back clean sheets away from home for di Premier League, dem managed just one for dia previous 24 on di road.

Brentford neva lose any Premier League game wey dem score di opening goal, dem don win 17 and draw four.

Line ups

Arsenal

1.Ramsdale

4. White

12.Saliba

6.Gabriel

35.Zinchenko

8. Ødegaard

5. Partey

34.Xhaka

7. Saka

14. Nketiah

11. Martinelli

Substitutes

3. Tierney

15. Kiwior

16. Holding

18. Tomiyasu

19. Trossard

20. Jorginho

21. Fábio Vieira

30. Turner

85. Cozier-Duberry